UK release white paper on immigration process for visa applicants for legal migrants

Keir Starmer addressing di press conference
Read am in 6 mins

Di UK Home office don drop wetin dem call immigration white paper to reduce migration and take strengthen di border.

For document wey dem drop on 12 May, di new requirements for employers to boost domestic trainning go end di reliance on international recruitment and go restore order to system wey see di amount of net migration to increase between 2019 and 2023.

Some of di policies wey dem dey try do na to change di trend of increased international recruitment instead of to use skills and training.

Dem also go create di labour market evidence group. Di work of dis group na to torchlight data so dem go fit make informed decisions about wetin dey happun for di labour market, instead of say dem go just dey rely on migration.

How di migration rules go take affect evribodi

Skilled Workers

Di level for skilled workers dey go bac to RQF 6 wey mean Graduate level and above. Di starting point for salary go also increase.

Dem go also commot di immigration salary list. Dis na di list wey dey give pipo discounts from di salary entry points.

But dem wan increase di number of pipo wey dey come from dia very high talent routes.

Dis include increasing places for research interns, to make am easier for top science and design talent to use Global Talent visa and review di Innovator Founder visa and High Potential Individual route.

Employers

Di access to di points based immigration system go come reduce to di kain work wey don face long term shortages.

Dis no go just be forever tho, e go get time limit according to wetin di Migration Advisory Committee (MAC) advice say make sense.

Employers wey dey recruit from abroad also need to commit say dem dey play dia part to increase recruitment from di workforce for house.

Financial penalties and sanctions fit dey imposed for sponsors (including institutions) wia abuse of di immigration system dey found.

Adult social care

Overseas recruitment for social care visas don end. So no new application.

But dem go keep di social workers from overseas for ground go still get visa extensions and in kontri switching toll 2028.

Students

UK don reduce how long graduates go fit stay afta dia studies finish to 18 months.

Dem dey consider to add levy on international students wey dem wan use to do domestic skills training.

Dem go also strengthen di requirements for sponsoring institutions to fit recruit or admit international students.

Family

Dem go create legislation to make am clear say na di goment and Parliament fit decide who get right to stay for di UK.

Dis go face di cases wia pipo dey use Article 8 right to family legal arguments dey use to frustrate deportation wey dey clearly in public interest.

Illegal working and foreign criminals

Migrants go get di digital IDs through eVisa wey go replace Biometric Residence Permits.

Dem go do more stronger checks go target pipo wey claim asylum witout say dem get any new serious risks for dia home kontri.

Dem go tackle illegal working more especially for sectors like di gig economy. Dis include using eVisas, biometric tech and extra enforcement staff.

Dem go announce more measures like faster removals later dis year.

Family members of British citizens go fit still settle for UK afta five years and protections fit still dey for domestic abuse victims.

Parents of British or settled pikin dem wey die go fit stay permanently for di UK.

Non-English speakers

English Language requirements for Skilled Workers and odas go increase from B1 to B2 wey be Independent User level under CEFR.

Adult dependants of workers and students go need to at least dey for A1 English level wey be Basic User. Dis na as long as dem get plans to improve over time.

Visa extensions go need proof of progress to A2 level and B2 level go dey needed for settlement.

Some settlement routes for need B2 level English instead of B1.

Prime Minister Keir Starmer don outline plans to tighten immigration system wia govment plan to cut migration numbers significantly.

Di proposed changes include English tests for all visa applicants and dia adult dependants, as well as a longer route to get settled status.

Di PM also wan cut recruitment of overseas care workers, di measures aim to reduce legal migration, wey make up di majority of migration to di UK.

E no include addressing small boat crossings, or oda ways pipo dey arrive UK without permission.

Net migration (di number of pipo wey dey enta di country, minus di number leaving) hit 728,000 in di year to June 2024.

Di UK say dia plan to cut migration na to break from di past and ensure say anybody wey go settle for di kontri go be privilege wey dem earn and not a right.

UK Home Office go release a White Paper wey go announce di new rules to tighten up work and study visas for di UK.

Meanwhile, Home Secretary Yvette Cooper tell di BBC say dis na time to end di recruitment of care workers from abroad.

Cooper add say dis new measures go cut up to 50,000 lower-skilled workers wey dey come from abroad next year.

Di goment plan to unveil series of changes to visa and recruitment laws on Monday, 12 May as part of efforts to cut dis net migration.

UK Prime Minister say di change wey dey inside di White Paper na "finally take back control of our borders".

White Paper na official goment document wey dey present di final, finished version of a goment proposal.

Dem dey use am share di plans wit di public and to provide guidance on how a policy go work.

Under one new goment plan to crackdown wey Home Office dey plan, pipo from kontris like Nigeria, Pakistan and Sri Lanka fit to find am more difficult to work and Study for UK.

'Dis plan mean say migration go fall' - UK Prime Minister

Starmer say Britain get to "compete for di best talent for di world" and dem go question why parts of di economy dey "almost addicted to importing cheap labour".

UK Prime Minister say di White Paper go set out evri area of di immigration system - work, family and study wey go help dem get more control.

"I dey do am becos e dey right, e dey fair, and na wetin I believe in," Starmer tell di news conference.

E say an immigration system dey almost permit abuse and one wey dey encourage some business to bring in low paid workers, rather dan investing in young pipo.

Starmer say net migration under di previous govment bin reach a record high of nearly one million for di year 2023.

"Make no mistake, dis plan mean say migration go fall, dat na promise."

If di govment go need to take further steps to release pressure on housing and public services, den we go do am, mark my words.

According to Starmer, dis number of migration na almost di size of di city of Birmingham wey be UK second largest city.

"Dat no be control, na kasala. You no fit do sometin like dat by accident, na by choice" .