Joe Biden get 'aggressive' prostate cancer

Wia dis foto come from, Getty Images
Former US President Joe Biden, 82, don dey has diagnosed wit prostate cancer wey don spread go im bones, statement from im office tok Sunday.
Biden, wey comot from office in January, dey diagnosed on Friday afta e see doctor last week for urinary symptoms.
Di Cancer na a more aggressive form of di disease, wey Gleason score 9 out of 10 for di level. Dis one mean say dem classify im sickness as "high-grade" and di cancer cells fit spread quickly, according to Cancer Research UK.
Tori be say Biden and im family dey review treatment options. Im office add say di cancer dey hormone-sensitive, meaning dem fit manage am.
For di Sunday statement, Biden office say: "Last week, President Joe Biden discover prostate nodule afta e experience increasing urinary symptoms.
"On Friday, dem diagnose am wit prostate cancer, characterised by a Gleason score of 9 (Grade Group 5) wit metastasis to di bone.
"While dis represent a more aggressive form of di disease, di cancer appear to be hormone-sensitive wey allow for effective management."
Afta di news break of im diagnosis, di former president receive support from evri wia.
President Donald Trump write ontop im social media platform Truth Social say im and First Lady Melania Trump dey "sad to hear about Joe Biden recent medical diagnosis".
"We extend our warmest and best wish to Jill and di family," e tok, as e refer to former First Lady Jill Biden. "We wish Joe a fast and successful recovery."
Former Vice-President Kamala Harris, wey serve under Biden, write on X say she and her husband Doug Emhoff dey pray for di Biden family.
"Joe na fighter – and I know say e go face dis challenge wit di same strength, determination, and hope wey dey part of im life and leadership," Harris tok.
For im post on X, Barack Obama – wey serve as president from 2009 to 2017 wit Joe Biden as im deputy – say im and im wife Michelle dey "think of di entire Biden family".
"Nobody don do more to find breakthrough treatments for cancer in all forms dan Joe, and I dey sure say e go fight dis challenge wit im trademark determination and grace. We pray for a fast and full recovery," Obama tok.
For 2016, Obama bin give Biden di work to lead a "cancer moonshot" government-wide research programme.
For di UK, Prime Minister Keir Starmer say: "I dey very sorry to hear say President Biden get prostate cancer. All di very best to Joe, im wife Jill and dia family, and I wish di president fast and successful treatment."
Wetin be prostate cancer
Di news come nearly one year afta di former president dey forced to drop out of di 2024 US presidential election sake of concerns about im health and age. E be oldest pesin to don hold di office in US history.
Biden, wey be di Democratic nominee to find re-election, face plenty criticism of im poor performance for one debate wey dem show for television for June against Republican nominee and current president Donald Trump. Dem replace am as di Democratic candidate wit vice-president, Kamala Harris.
Prostate cancer na di second most common cancer wey dey affect men, behind skin cancer, according to di Cleveland Clinic.
Di US Centres for Disease Control and Prevention (CDC) say 13 out of evri 100 men go get prostate cancer at some point in dia life.
Age na di most common risk factor, di CDC tok.
Dr William Dahut, di Chief Scientific Officer for di American Cancer Society and a trained prostate cancer physician, tell di BBC say di cancer dey more aggressive in nature, based on di informate wey dey publicly on Biden diagnosis.
"In general, if cancer don spread to di bones, we no tink say na cancer wey dem fit cure," Dr Dahut tok.
E add say, however, most patients dey fit respond well to initial treatment, "and pipo fit live many years wit di diagnosis".
Dr Dahut say dem fit offer pesin wit di kain diagnosis wey di former president get hormonal therapies to slow down di symptoms and to slow di growth of cancerous cells.
Biden bin don dey away from public eye since e comot from di White House and e don make few public appearances.
Di former president deliver a keynote speech in April for Chicago conference wey di Advocates, Counsellors, and Representatives for di Disabled hold, a US-based advocacy group for pipo wit disabilities.
In May, e siddon wit di BBC for interview – im first since e leave di White House – wia e gree say di decision to step down from di 2024 race bin "hard".
Biden don face kwesions about di state of im health recently.
For one appearance on The View programme wey also happun for May, Biden deny claims say im thinking bin don dey drop towards di end of im stay for White House. "Nothing dey to sustain dat," e tok.
For many years, di president bin don advocate for cancer research.
In 2022, im and Mrs Biden relaunch di "cancer moonshot" initiative wit di aim of mobilising research efforts to reduce more dan four million cancer deaths by di year 2047.
Biden imsef lose im eldest son, Beau, to brain cancer in 2015.










