Tinubu, Zelensky and oda world leaders attend Pope Leo XIV inauguration Mass

Di pope during im inauguration

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 4 mins

Di inauguration mass of Pope Leo XIV as di 267th Pope of di Catholic Church dey hapun for St Peter's Square for di Vatican.

Di service go mark di official start of im papacy.

World leaders wey include Nigeria President Bola Tinubu, US Vice-President JD Vance, and Ukrainian President Volodymyr Zelensky dey among di hundreds of dignitaries wey go attend di inauguration mass wey go start at 10:00 am (0800 GMT).

Dem choose Leo as di new leader of the Catholic Church earlier dis month afta di death of im predecessor, Pope Francis, and one two-day conclave for Vatican City.

Leo na di 267th Pope and di first to come from US.

For im first Mass on 8 May, afta di conclave elect am as Pope, Leo use di service to call for unity for di Catholic Church and an end to war

Di first US pontiff bin make im debut tour of St Peter's Square on Sunday for inside one popemobile, e greet thousands of pilgrims and well-wishers wey gada ahead of im inauguration mass.

Pope Leo go preside ova di ceremony rich in rites and symbols, wia e go receive im special papal ring, and give one sermon wey go set di tone for im papacy.

Pope condemn exploitation and autocracy for im inauguration Mass

Pope Leo XIV inauguration Mass dey go on for di Vatican

Wia dis foto come from, Getty Images

Pope Leo XIV bin lay out im priorities for im papacy on Sunday, e condemn exploitation of di poor and autocrats during one homily to a crowd of thousands including world dignitaries.

Speaking for St Peter's Square, di Pope use im inaugural Mass to echo di priorities of im predecessor, Francis.

E criticise "hatred, violence, prejudice, di fear of difference, and economic paradigm wey dey exploit di Earth resources and sideline di poorest," e tok.

Nigeria President Bola Tinubu, US Vice President JD Vance, di US Secretary of State Marco Rubio and Ukrainian President Volodymyr Zelensky, dey among those wey attend di mass.

Di Vatican say di Pope go later meet Zelensky in private to discuss di war for Ukraine.

Di Pope say e wan see a more united church and say make pipo no dey gada togeda in small groups and or dey act like say dem dey superior to di world.

"I come to you as a brother," e tok.

E add say im go like lead "without ever yielding to di temptation to be an autocrat".

Thousands of pilgrims full di square and stand in reverence as di pope receive di symbols of office, e bless di pipo and call for a strong call for unity.

Pope Leo receive im unique ring shortly bifor e begin im Mass

Wia dis foto come from, Getty Images

During di inauguration, one cardinal give di Pope - Ring of the Fisherman. Dis special ring na symbol of im role, and na one tradition wey date back to di time of Saint Peter, wey be fisherman.

Pope Leo also receive di pallium, one strip of lambswool, wey symbolize im role as a shepherd.

For im sermon, di 267th pontiff call for unity within di church, and e say na "wit fear and trembling" im dey approach di church followers "as a brother".

Fotos from di Pope mass inauguration

Pope Leo XIV take communion for di altar during Mass

Wia dis foto come from, Reuters

Faithful attend as Pope Leo XIV hold im inaugural Mass inaugural for Saint Peter's Square, for di Vatican

Wia dis foto come from, Reuters

Pope Leo XIV inauguration Mass

Wia dis foto come from, Reuters