Why Popes dey change dia names and wetin di names mean?

Pope Leo XVI

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 5 mins

Dem don elect Cardinal Robert Prevost as di new pope and e go dey known as Pope Leo XIV.

Di 69-year-old na di first American to become pontiff and e go lead members of di Catholic Church global community of 1.4bn pipo.

Born in Chicago, many pipo see am reformer. E work for many years as missionary for Peru bifor dem make am archbishop for there.

E also get Peruvian nationality and pipo remember am well as one pesin wey work wit marginalised communities and help build bridges for di local Church.

Why popes dey choose different names?

Pope Francis wit im hands for preying gesture as e appear for di first time afta im election as pontiff

Di first tin new Pope dey do, immediately afta e accept im canonical election as Supreme Pontiff and bifor e begin do oda things, na to choose a name. Afta e choose di name e wan dey known as, di Cardinal Protodeacon go announce di name afta di famous formula "Habemus Papam", e go dey followed by di Pope baptismal name for Latin.

Di decision na part of one longstanding tradition, but no be so e be bifor.

For more dan 500 years, popes bin dey use dia own names.

E later change to to symbolic names in order to make dia original names dey simple or to refer to previous pontiffs.

Ova di years, popes don choose di names of dia immediate or distant predecessors out of respect or admiration and to signal di desire to follow for dia footsteps and continue di most relevant pontificates.

For example, Pope Francis tok say im name na to honour St Francis of Assisi, plus say im dey inspired by im Brazilian friend Cardinal Claudio Hummes.

Why di new Pope choose Leo XIV as a name?

Pope Leo XIV stand for balcony bifor di crowd for St Peter's Square, e hold im hands up alongside two Vatican officials

Wia dis foto come from, Reuters

Di new Pope neva tok why e wan dey known as Pope Leo XIV.

Many reasons fit dey for dis decision, but many popes don use di name Leo ova di years.

However, di name a new pope choose dey "show certain spirit and direction and vision of di new pope, "Dennis Doyle, one theologian and professor emeritus of religious studies for di University of Dayton tell CBS News.

"Di first tin you go look for go be, which pope don use dat name bifor?" e tok." Dat go signify sometin about di direction wey di new pope wan take."

Rev Fr Ben Onyemechalu, one priest for di Catholic Archdiocese of Abuja tell BBC News Pidgin say popes dey change dia names to mark new spiritual mission and dem dey choose a new name to symbolize transformation.

"Dem often dey choose names to honour a particular saint of interest or a past pope whose legacy dem wish to follow."

"Wetin dis mean for our new pope? e fit mean say im to stand go up to oppressive political forces for di world," Fr Onyemechalu tok.

Di name Leo "na deep sign of commitment to social issues," Natalia Imperatori-Lee, di chairman of religious studies for Manhattan University, tell The Associated Press.

Dem don chose di name Leo 13 times bifor.

Di first Pope Leo I, wey also dey known as St Leo di Great, na pontiff between 440 and 461 AD.

E be di 45th pope in history and e dey known for im commitment to peace.

According to legend, di miraculous apparition of Saints Peter and Paul during di meeting between Pope Leo I and Attila di king of di Huns for 452 AD make di king stop to dey attack Italy.

Who be Leo XIII?

King Leo XIII siddon for chair

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, King Leo XIII dey known for im dedication to social justice

Di last pope to choose di name Leo na Pope Leo XIII, one Italian wey im baptismal name na Vincenzo Gioacchino Pecci.

Dem elect am for 1878, e be di 256th occupant of di throne of St Peter and e lead di Catholic Church until im death for 1903.

E dey remembered as a pope wey dey dedicated to social policies and social justice.

E dey particularly known for issuing encyclical - one letter e send to bishops of di Church – called "Rerum Novarum", one Latin expression wey mean "Of New Things".

Di encyclical bin include topics like workers' rights and social justice.

Pope Leo XIV stand for balcony e dey look St Peter's Square during im first appearance as pontiff

Wia dis foto come from, Reuters

Leo dey among some of di most popular papal names.

Di most commonly used name na John, Saint John I, Pope and Martyr bin use am first for 523.

Di last pope wey choose dis name na Italian Angelo Giuseppe Roncalli, e dey elected as Pope John XXIII for 1958, Pope Francis declare am as saint for 2014.