Cardinals elect first American pope

Wia dis foto come from, Vatican Media Handout
US President Donald Trump don congratulate di new Pope - di first American pontiff - describing am as an "honour" for di country.
Di US president tok on im social media platform, Truth Social:, external "Congratulations to Cardinal Robert Francis Prevost, wey dem just name Pope.
"Na such an honour to realise say e be di first American Pope. Na excitement, and what a Great Honor for our Country. I look forward to meeting Pope Leo XIV. E go be a very meaningful moment!"
White smoke bin comot from di chimney for di Vatican, wey mean say di Cardinals don elect a new pope on Thursday evening.
Di new Pope na American, Robert Prevost wey go dey known as Pope Leo also don appear for di Vatican balcony to address di crowd.
Tins move fast afta di white smoke confam say di Cardinals don vote.
Di new pontiff appear on di balcony overlooking St Peter's Square withing di hour.
E wear di papal robes wia di senior cardinal confirm di decision wit di words "Habemus Papam" - Latin for "we don get Pope" - and introduce di new pontiff by di papal name wey e choose - Pope Leo.

Wia dis foto come from, Reuters
Earlier on di i crowd clap, cheer as di white smoke bin rise, everybody bin run forward to see am.
Pipo bin dey jump up with joy, some dey pray to di sky. One couple from Greece say na a "once in a life time experience", adding say dem go wait to see di new pope appear on di balcony.
Di sound bin loud, di bells ring loudly, e sound around di square as pipo dey cheer and scream with joy.
We still dey update dis breaking news.












