Profile of Robert Prevost, wey go dey known as Pope Leo XIV

Wia dis foto come from, Reuters
Di new Pope na American, Robert Prevost wey go dey known as Pope Leo, don appear for di Vatican balcony.
Addressing di cheering crowd in Italian, di 69-year-old say: "Peace be with all of you.
"Brothers and sisters dearest, dis na di first greeting of Christ resurrected. I go like to offer a greeting of peace to reach your families, all of you, wherever you dey. May peace be with you."
E pay tribute to im predecessor, Pope Francis, as e say e wan to deliver im own blessing to di people as Pope Francis do for im last appearance for St Peter's Square.
"Humanity need Christ as a bridge to dey reached by God and im love. Help us, and help each other, build bridges."
Pope Leo XIV kon thank di cardinals wey elect am during di two-day conclave.
"We fit all walk together towards dat homeland wey God don prepare for us," e tok. "A special greeting to di Church of Rome."
Provost come switch to Spanish to thank im former diocese Pefor ru "where a loyal people don share dia faith and don give a lot".
Switching back to Italian, di new pontiff call on di crowd to pray to di Virgin Mary "together" for her blessing.
E kon lead di people in a quick prayer.
After concluding im speech, di new Pope begin to read a religious passage in Latin wey pay homage to di saints and di Madonna.
As e conclude di reading with a further blessing, Pope Leo XIV wave give di crowd wey fill up most of St Peter's Square.
Even bifor dem announce im name from di balcony of St Peter's Basilica, di crowds wey dey ground bin dey chant "Viva il Papa" - Long live di Pope.
Robert Prevost, go be di 267th occupant of di throne of St Peter.
Dem consider am much as a cardinal from Latin America sake of say im bin spend many years as a missionary for Peru, bifor im become archbishop for dere.
Im bin serve as altar boy and dem bin ordain am as priest for1982. Although im bin move to Peru three years later, im bin dey come US evritime to serve as a pastor and a prior for im home city.
Im get Peruvian nationality and go dey fondly remembered as one pesin wey bin work wit marginalised communities and bin also help build bridges for di local Church.
Im bin spend 10 years as a local parish pastor and as a teacher for seminary for Trujillo for north-western Peru.
Profile of Pope Leo XIV
According to publication from di College of Cardinals, Pope Leo di XIV dey 69 years.
Na on 14 September 1955 dem born am for Chicago Illinois, USA.
Im dey take ova from di late Pope Francis wey die last month from pneumonia.
Di cardinal college add for dia publication say, Cardinal Robert Francis Prevost, wey be di new Pope now na former prefect of di influential Dicastery for Bishops.
Im also be Chicago-born prelate wit views wey dey close to Pope Francis wey bin spend many years as missionary for Peru bifor dem elect am as di head of di Augustinians for two consecutive terms.
Robert Prevost now Pope Leo, bin enta di novitiate of di Order of Saint Augustine (OSA) for 1977 and im bin make im solemn vows for 1981.
Im education, im get Bachelor of Science for Mathematics from Villanova University for 1977. Master of Divinity from Catholic Theological Union for Chicago, and im be both a licentiate and doctorate degree holder in canon law from di Pontifical College of St. Thomas Aquinas for Rome.
Dem add say im doctoral thesis bin centre on "The role of the local prior in di Order of Saint Augustine."











