'Plenty killings for di southeast dey directly connected to Nnamdi Kanu broadcasts' - DSS tok for court
- Author, Chukwunaeme Obiejesi
- Role, Reporter
- Reporting from, Abuja
- Read am in 4 mins
One witness for di ongoing trial of Nnamdi Kanu, leader of Indigenous People of Biafra (Ipob), tok say dia investigation establish say many of di killings wey bin happen for di southeast dey directly connected to broadcasts wey Kanu bin make.
Di witness wey give im name as Mr BBB say im na one of di officers of di Department of State Service (DSS) wey bin interrogate Kanu and take im statement for dia headquarters for Abuja.
E be di second witness wey di nigeria goment dey call for di trial as dem accuse Nnamdi Kanu of terrorism.
Some of di violent murders wey BBB tok say dey connected wit Nnamdi Kanu broadcasts include di killing of former special adviser to di President, Ahmed Gulak, wey jaguda pipo bin kpai on May 30, 2021 for Imo State.
According to di witness, dat day - May 30 - na di day wey Kanu bin declare sit at home, and e bin threaten for im broadcast say anybodi wey come out dat day, anytin e see make e take.
Eyewitnesses tell us say di killers bin dey ask Gulak why e dare to come out on a day dia leader declare as 'sit-at-hom' day, Mr BBB tok.
Anoda example na di murder of one army couple - Gloria Mathew and Linus Musa - wey di killers also cut off dia heads as dem dey travel for dia traditional marriage.
BBB remind di court of one Kanu broadcast wey di court bin play during di hearing of Wednesday, May 7, 2025, wia Kanu allegedly ask im followers to attack police and army pipo and to cut off dia heads.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kanu deny responsibility for wetin happun for Lagos during EndSARS protest - DSS video
Also, during Thursday hearing, di court play one CD plate wia DSS officers dey interview Nnamdi Kanu for dia headquarters for Abuja for July 17, 2021.
For dat video, Kanu wey wear black sweater dey wit im lawyers - one of dem na Aloy Ejimako.
Di DSS officers ask Kanu weda e dey aware say im broadcast on October 20, 2020 bin lead to violence, killings and destruction of public infrastructure for Lagos State, Kanu say "Lagos no be Biafran territory so wetin happun for Lagos no fit dey attributed to me".
"But you get authority ova all di pipo for di southeast?" di DSS officers bin ask Kanu, and e say e no get such authority.
"If I get dat kain authority ova dem, I no for dey call for referendum, I for just wake up one day and say make we get Biafra," Kanu tok.
"We get republican orientation. Anybody wey claim say e get control ova di pipo of di east dey make mistake. We dey republican in nature," Kanu tok.
E say even though im be leader of di Ipob movement, di running of di day to day affairs of di group na di job of di directorate of state of di group.
Wen dem ask am weda e dey aware say Ipob elements don dey associated wit violence and killings, Kanu reject di allegation kpatakpata.
"You just dey look for somtin wey you go pin on Ipob to call am violent group."

Di DSS pipo ask Kanu about di statement im bin make on 30 May 2021 wia e call for sit-at-home, e respond say e call for sit-at-home true-true, but e no force anybodi.
Wen dem ask Kanu weda e know say some of im Ipob members bin attack and kpai pipo for coming out during 'sit-at-home-day', Kanu deny am and say Ipob na peaceful group.
"E just be like wen your pikin offend you for house and you say to am 'I go kill you today', shey dat one mean say you go kill di pikin?" Kanu tok for di video, to explain say di things wey im tok during some of im broadcasts.
For im final remarks for di video, Kanu tok say: "Di pesin wey ask di army to attack my house, dat pesin na di real enemy, becos I bin already dey for discussions wit eminent pipo for di southeast including Professor Ban Nwabueze as we dey try to get political solution to dis matter."














