Five takeaways from Biden first interview after e comot White House

Wetin we call dis Video, Watch: Biden first interview since e leave di White House
    • Author, Anthony Zurcher
    • Role, North America correspondent
  • Read am in 4 mins

Former US President Joe Biden don give im first in-depth interview since e comot from di White House for January, for toks wit di BBC about im legacy, foreign policy and im view of President Donald Trump first 100 days.

E tok say e get few regrets, but e offer serious warnings about global affairs as Europe mark 80 years since di end of World War Two on di continent.

Biden bin spend much of im time in public office – as a senator, vice-president and president – wit focus on US foreign policy, and e remain a top concern.

Di former president bin also reflect on im decision to drop out of di 2024 election race - but e bin get less to say about any mistakes wey im and di Democrats fit don make along di way.

Dis na five key takeaways from im interview wit Nick Robinson for BBC Radio 4 Today programme.

E admit say di decision to quit 2024 race dey 'difficult'

Wetin we call dis Video, Biden: To withdraw from di 2024 race earlier 'for no matter'

Biden ill-fated decision to seek second presidential term fit haunt Democrats for a generation. Three months after e comot from power, however, di former president tok say e no tink say "e for don matter" if e bin don abandon im re-election ambitions earlier, bifor one disastrous debate bin force im hand for July 2024.

Kamala Harris, wey become di nominee afta Biden bin drop out just four months bifor di election, na "good candidate" wey bin dey "fully funded", e tok.

Democratic strategists don lament say just last-minute handover bin leave dia campaign flat-footed, and ultimately help Trump path to di White House, even as Democrats bin hold financial advantage for di 2024 race.

Biden bin boast say e dey "so successful on our agenda" – a reference to di major legislation wey dem establish for im first two years in office on di environment, infrastructure and social spending, as well as di better-dan-expected Democratic performance in di 2022 midterm elections.

"E bin dey hard to say now I dey stop," e tok. "Tins bin move so quickly dat e bin make am difficult to walk away."

Ultimately, to quit na "di right decision", e tok but e "just be difficult decision".

Strong accusation of 'modern-day appeasement'

Biden describe di Trump administration suggestion say make Ukraine give up territory as part of one peace deal wit Russia as "modern-day appeasement" - a reference to European allies wey bin allow Adolf Hitler to annex Czechoslovakia for di 1930s inside one ill-fated attempt to prevent a continent-wide conflict.

"I just no understand how pipo dey tink say if we allow a dictator, a thug, to decide, e go take significant portions of land wey no be im own, say e go satisfy am. I no really understand," Biden tok about Russian President Vladimir Putin.

Di term "appeasement", na sometin wey dem dey use well-well American politics, and di list of foreign leaders compare wit modern-day "Hitlers" na long one.

Though Biden repeat tok say Russian tanks go dey roll through central Europe if America and im allies no support Ukraine dey impossible to prove, e view di threat posed by Putin as serious and worthy of di comparison.

Biden also tok say if di US bin allow one peace deal wey favour Russia, Putin neighbours go dey under economic, military and political pressure to accommodate Moscow will in oda ways. For im view, di promise of American support to European allies go become less believable and no go carry too much weight.

Wetin we call dis Video, Watch: Biden say Trump approach to Ukraine war na "modern-day appeasement"

US-Europe alliance at risk

Under Biden, the US help to expand Nato to include Finland and Sweden – one of di former president signature foreign policy achievements. Now, e tok say Trump dey turn im back on America European allies and threaten di very foundations of Nato and im mutual defence agreement.

Di former president describe di thought of Nato breaking apart as "grave concern". Already, e warn say, US allies dey doubt American leadership.

"I tink say e go change di modern history of di world if e happun," e tok. "We no be di essential nation, but we be di only nation in position to get di capacity to bring pipo togeda to lead di world."

Some dey inside Trump circle – perhaps including di president imself – wey believe say America, wey dey less concerned wit global security and more focused on regional self-sufficiency, na di best way to make sure of a long-term prosperity in a world of competing global powers. Dem argue say America post-Cold War dominance na historical abnormality.

Biden, wey im political career cut across those decades of American supremacy, disagree.

Greenland, Canada and di Panama Canal: 'What di hell dey go on here?'

Inside im interview, Biden bin sound like most modern American presidents bifor am. E use words like freedom, democracy and opportunity to describe American principles.

But in Biden view, those principles also include a sense of decorum, especially towards long-standing allies.

E tok say Trump February meeting-turned-argument wit Ukrainian President Volodymyr Zelensky for di Oval Office dey "sort of beneath America". E argue say Trump eye for di territory of Canada, Greenland and di Panama Canal "no be who we be".

"Which president dey ever tok like dat? Dat no be who we be. We dey about freedom, democracy, opportunity, no be about confiscation," e tok.

Lukewarm response to Trump first 100 days

Wen dem ask am about Trump first 100 days in office - wey bin include dramatic attempts to expand presidential power - Biden tok say e go let history judge im successor, but "I no see anytin wey dey triumphant".

Na di kind of understatement wey surely go annoy some on di left. Since di start of Trump second term, rank-and-file Democrats don dey push for dia party to do more to resist di president agenda.

Biden tok say e no tink say Trump go succeed to go against di courts or di law, or diminish congressional power, partly because di president fellow Republicans dey "wake up to wetin Trump dey about".

"I no tink say e go succeed in dat effort," e tok.

Di idea say members of Trump own party go turn on am no be new tin wit Biden. For 2019, e predict say "epiphany" go dey among Republicans once Trump dey out of di White House, e go usher in a new era of bipartisanship.

E no exactly work out dat way for 2024.