Hushpuppi: Dubai beef up cyber security afta di arrest of Nigerian Ramoni Igbalode

Wia dis foto come from, SCREENSHOT/DUBAI MEDIA OFFICE TWITTER VIDEO
Di Crown Prince of Dubai, Sheikh Hamdan bin Mohammed bin Rashid Al Maktoum don launch cyber index to promote online safety standards for di city.
Dis dey come afta di "Fox hunt 2" operation wey di UAE police take use arrest popular Nigerian instagram celebrity, Ramoni Igbalode Abbas AKA Hushpuppi and eleven oda pipo for internet mago-mago.
Dubai Cyber Index na initiative wey go support di efforts of Dubai goment entities to ensure di highest standards of cyber security.
Dis na di first initiative of im kind for di whole world, di Index go make Dubai become di city wit di safest cyberspace for di world.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Twitter / @HamdanMohammed
Wetin di cyber security index go do?
One of di key objectives of di newly launched Index na to deal wit cyber crises and emergency scenarios.
E go ensure di security and safety of all communication networks and information systems for di kontri.
Di Index go create one strong foundation for free, safe and resilient online world for both individual users and even organisations.
E go create one central system wey go connect all di internet of Dubai.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di index go set up advanced Artificial Intelligence technologies and Big Data analysis wey go detect any potential cyber threats.
Di index go dey monitor all di overall cyber security performance of goment entities.
Di Dubai Cyber Index na to further raise di security and safety standards of Dubai, dis na wetin Sheikh Hamdan bin Mohammed tok as im launch di initiative on Wednesday July 7, 2020.












