Hushpuppi extradited to US: Ramoni Igbalode and Woodberry go face 'fraud accusation' outside Dubai - Police

Ramoni Igbalode

Wia dis foto come from, Hushpuppi/Instagram

Read am in 2 mins

Di United Arab Emirates don deport one alleged internet fraudster, Raymond Igbalode Abbas wey dem dey call Hushpuppi, give di Federal Bureau of Investigation (FBI) for America.

Di Dubai police reveal dis one for inside statement wey dem post for dia twitter handle.

Recently, di Dubai Police arrest di two wanted fraudsters, "Hushpuppi" and "Woodberry" along with ten African cybercriminals for one special operation wey dem call "Fox Hunt 2".

Di operation take down di suspects for committing crimes outside di UAE, plus money-laundering, cyber fraud, hacking, criminal impersonating, scamming individuals, banking fraud and identity theft.

Dem catch di suspects for one series of synchronised raids by six SWAT teams from Dubai Police who spoil di plan of di gang to deceive plenti people from around di world and steal dia moni.

Olalekan Jacob Ponle wey pipo also know as Woodberry one of di internet fraudster Dubai police arrest

Wia dis foto come from, mrwoodberry/TWITTER

Wetin we call dis foto, Olalekan Jacob Ponle wey pipo also know as Woodberry one of di internet fraudster Dubai police arrest

Di Director of di Federal Bureau of Investigation (FBI), Christopher Wray, praise di ogbonge work wey di United Arab Emirate Dubai Police General HQ do to arrest Raymond Igbalode Abbas, known as "Hushpuppi" and Olalekan Jacob Ponle aka "Woodberry" for dia operation "Fox Hunt 2".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Mr Wray extend im appreciations to Dubai Police for dia cooperation to extradite di wanted criminals, who commit money-laundering and multiple cybercrimes, to di United States.

Di director of Dubai CID, Brigadier Jamal Salem Al Jallaf tok say from di raid, dem gbab documents of one planned fraud wey worth 435million dollars.

Di Dubai police say dem also seize:•More dan $40.9 million cash moni•13 expensive cars wey worth $6.8 million moni wey dem get from mago-mago activities•21 computer device•47 smartphones•15 memory stick•Five hard disk wey contain 119,580 fraud files•Address of 1,926,400 victims.