Thai cave rescue: Four more boys don comot, but dia coach, four odas still dey inside cave

BBC tori pipo see Ambulance dey drive comot with sirens for di rescue area

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Some of diplayers for Wild Boars still dey wait make dme release all of di team
Read am in 1 mins

Rescuers for Thai cave don comot four more boys from di cave as di operation to comot dem don enta di second day.

Di Thai Navy Seals wey dey lead di operation don tok say na eight boys in total dem don comot from di cave.

Four boys and di coach still de four inside di cave.

Tori be say, dem dey comot di boys wey no too strong for di cave first.

Ambulance and tori pipo for di Thailand cave rescue of youth football team
Wetin we call dis foto, BBC tori pipo see Ambulance dey drive comot with sirens for di rescue area

Tori be say dem dey di field hospital near di cave, according to di rescue officials.

But e no tey afta when BBC Tori pesin wey dey wia di rescue dey happen say ambulance wey dey blow sirens just drive comot from di area.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Tori bin comot today say some of di boys wey trap inside di cave fit comot dis afternoon as officials say e fit reach three days to rescue evribodi.

E don reach 14 days since di 12 boys and dia coach bin trap inside di cave afta dem bin go celebrate birthday.