Mikel Obi hear say dem kidnap im papa four hours before Nigeria play Argentina

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria captain John Mikel Obi hear say dem kidnap im papa and dem go kill am if im tok anitin, four hours before Nigeria play Argentina for dia last group game.
Di Super Eagles midfielder receive di shock news as dem dey travel inside bus to di stadium for St Petersburg last Tuesday.
Dem kidnap Pa Michael Obi along di Makurdi-Enugu expressway as im dey travel go one burial from Jos.
Mikel come later tweet wia im thank Nigeria Police.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Nigeria Police rescue Pa Michael on Monday, but Mikel say dem torture im papa and im dey currently receive treatment for hospital.

Wia dis foto come from, Getty Images
Mikel tell UK tori pipo Guardian say im "try to control di shock" as im decide weda im dey "mentally ready to play.
"I confuse, dem tell me say dem go shoot my papa if I report di mata give anibodi.
"I no discuss am wit di coach [Gernot Rohr] becos I no want my issue to become distraction to am or di rest of di team on di day of important game."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis na di second time wey dem dey kidnap Mikel Obi papa.












