Femi Gbajabiamila meet Prez Nana Akufo-Addo for Jubilee House wia Nigeria and Ghana agree key interests ontop Nigeria vs Ghana 'trade war'

Wia dis foto come from, Ghana Presidency
On Thursday, 3 September 2020, Speaker of Nigeria House of Representatives, Femi Gbajabiamila visit President Nana Akufo Addo for Jubilee House, di seat of power for Ghana to end im one day official waka inside di west African nation.
Di discussions bin center on to strengthen further di already-strong relationship of co-operation and friendship wey exist between di two kontris, according to Ghana president Nana Akufo-Addo.
According to president Akufo-Addo, e dey important for di progress of West Africa and Africa say Nigeria and Ghana dey work togeda.

Wia dis foto come from, Femi Gbajabiamila

Wia dis foto come from, Ghana Presidency
During di tok tok, President say, "fear catch me becos, if na so di Federal Goment of Nigeria bin tink , den we for ey serious trouble."
Oga Gbagabiamila bin do tok tok wit im Ghana counterpart to find lasting solution to di tension between di two knotris.
Di Nigeria Speaker say im hope say dem go find solution wey go take into consideration di interest of di two kontris.

Wia dis foto come from, Presidency of Ghana
Nigeria and Ghana bin do tok tok on Wednesday for Accra, afta plenty gbas gbos on top how Ghana dey take maltreat Nigerians wey dey dia kontri.
Tension increase afta Ghana implement law wey no allow foreigners to do business for dia kontri unless dem get capital up to $1 million.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ghana close more dan 200 shops, most of di owners na Nigeria.
See di complains we Nigeria Speaker cari go Ghana
- Di Nigerian Mission property wey dem seize. Di property dey for No. 10, Barnes Road, Accra. Nigerian Government don dey use dis property as diplomatic premises for almost 50 years and say dis thing wey dem do fit cause serious problem as dem don break di Vienna Convention rule.
- Demolition of di Nigerian Mission property wey dey for No. 19/21 Julius Nyerere Street, East Ridge, Accra, another serious Vienna Convention rule wey dem break.
- Di violent and continuous way dem take dey deport Nigerians from Ghana. Between Jan. 2018 and Feb. 2019, dem don deport 825 Nigerians from Ghana.
- Closure of shops wey belong to Nigerians. Over 300 Nigerians shops na im dem lock up for four months for Kumasi in 2018; dem lock over 600 Nigerian shops in 2019 and, currently, over 250 Nigerians shops na im dey locked.
- Ghana Immigrtion Service don put big money on top Residency Permit requirements, di money high pass di fees wey di Nigerian Immigration Service dey charge. These include di compulsory Non-citizen ID card wey cost (US$120, and US$60 for yearly renewal); Medical examinations, Covid-19 wey dem just introduce go cost about ($120), and payment for residency permit (US$400 compare to di N7,000 Ghanaians dey pay for residency card for Nigeria).
- Outrageous stipulations for di Ghana Investment Promotion Centre Act. When dem start di Act for 1994, foreigner go gats invest at least US$300,000 by way of equity capital and also employ 10 Ghanaians. Dem don amend dis act two times now, di 2018 GIPC Act don raise di minimum capital base for foreign-owned businesses to US$1m. Although na foreigners dem tok but e be like say di GIPC's definition of foreigners na Nigerians. Di GIPC Act also dey against di ECOWAS Protocol.
- Media war against Nigerians in Ghana. Di media for Ghana always dey carry negative tori about Nigerians wey dey live for Ghana. Dis kain tori dey fuel emerging xenophobic attitude towards Nigerian traders and Nigerians in general. Dis don lead to di continuous harassment and arrest of Nigerian traders and closure of their shops.
- Harsh and one sided judicial trial and pronouncement of indiscriminately-long jail terms for convicted Nigerians. More than 200 Nigerians na im dey di Nsawam Maximum prison in Ghana alone.
Shortly before di meeting see wetin Ghana tok ontop di mata


















