School resumption date: FG ask schools to prepare for reopening, relax nationwide curfew time

Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Twitter/@BashirAhmaad

Nigerian goment say state goment dem plus school administrators make dem make plans and prepare for di full reopening of schools for di kontri.

Di National Coordinator of di Presidential Taskforce, Sani Aliyu tell tori pipo dis one for Abuja during di Presidential taskforce briefing on Covid-19 on Thursday.

Aliyu tok wen im outline di new guidelines for di third phase of di eased lockdown for di kontri wey dey begin effective midnight.

E explain say educational institutions like daycare, primary, secondary and tertiary institutions gatz begin prepare to see how dem fit open within dis third phase of di easing of di lockdown.

E say di taskforce recommendation na be say make state goment dem conduct risk assessment to ensure say all schools for every level follow di lay down covid 19 protocol and also make sure dem get strategy on ground to take monitor how di schools dem dey ready.

Oga Aliyu say all schools dem gatz remain close to in classes studies until di state goment dem cari out dia risk assessment and dey sure say everitin dey kampe.

E say if school ready to open, dem no go open at once, dem go do am stage by stage to prevent di spread of covid 19 to vulnerable group wey fit catch di disease from school pikin dem.

Under di third phase of di easing of di lockdown, FG also extend di nationwide curfew wey bin dey in place for di kontri for months now from 10:00pm-4:00pm to 12am-4:00am.

Dis one no apply to essential workers and those wey just dey return from abroad.

Na for March 30, di president bin first order total lockdown for Lagos, Ogun and Abuja to stop di spread of di virus.

Nigerian schools resumption date

Wia dis foto come from, OTHER

Wetin we call dis foto, Currently, na only students for final year or national exam classes dey go school across di 36 states of Nigeria but states fit decide to open am fully

See oda rules for di third phase of di lockdown

  • Markets to fully open
  • Hotels to remain open
  • Parks, gyms, cinemas go open - but at 50% capacity
  • Event centres - 50% capacity, not indoor event centres.
  • Eateries - outdoor services only.
  • Bars / night clubs - closed till further notice.
  • NYSC - Go start preparing for reopening / wen schools open / Dem go adhere to strict guidelines
  • INEC - Di body go ensure compliance for dia elections - No face mask - no voting, dem go do temperature checks, use sanitizer, do social distancing
  • Religious centres - restrict opening subject to current guidelines - recommend multiples services
  • Weddings, meetings - 50 people outdoors, preferably outdoor weddings, dem must adhere to di Covid- 19 rules.
  • Airports - Abuja / Lagos go open on 5 September, 2020 for international flights.
  • Education - Potential reopening / FG recommend states to conduct risk assessment for compliance but to remain closed to in-person classes.

Di PTF say States go provide additional guidelines to add to di one FG don do.