N-Power shortlist 2020 programme successful candidates for second stage? See latest you need to know

N-Power shortlist

Wia dis foto come from, N-Power 2020 registration

N-Power Programme wey Nigeria goment arrange to employ young pipo don clear latest news about Batch C application wey dey fly upandan about shortlisted successful candidates for second stage of di 2020 programme.

Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development wey dey supervise di N-Power programme say tori about successful candidates for second stage na fake news for now.

Na sake of dis di N-Power handle even post warning for dia Twitter handle for pipo to beware of Fraudsters and Fake News ontop dis mata.

Di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development say dem go communicate through dia official channels.

N-Power shortlist

Wia dis foto come from, Federal Ministry of Humanitarian Affairs

Wetin we call dis foto, Federal Ministry of Humanitarian Affairs say dis N-Power website na fake
N-Power shortlist

Wia dis foto come from, Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster

Wetin we call dis foto, Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development say na fraudsters create di fake website
N-Power shortlist

Wia dis foto come from, Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster

Wetin we call dis foto, Na afta N-Power clear di money alias stipends for Batch A and B before dem go tok of employing new set of beneficiaries.

Di N-Power portal Batch C application bin close on Sunday 9 August, 2020 afta e receive over 5 million applications.

BBC Pidgin find out say di supervising ministry of di N-Power programme don start to review di application wey pipo submit and dem dey make efforts seriously to clear di money alias stipends for Batch A and B before dem go tok of employing new set of beneficiaries.

N-Power shortlist

Wia dis foto come from, N-POWER/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, N-POWER Beneficiaries

On Thursday di Minister in Charge of N-Power programme Sadiya Umar tokfor Katsina during one interactive session say dem don appoint focal persons wey State Govnors choose to oversee the Social Investment Programmes of Federal Government like N-Power, Market-Moni and Conditional Cash Transfer.

All dis programmes na to take reduce di effect of di unemployment rate for Nigeria.