Nigerian schools resumption date and private universities concerns as FG okay reopening of schools

School resumption date

Wia dis foto come from, State House

Wetin we call dis foto, Nigeria get more than 75 private universities, according to Nigeria University Commission.

Federal goment don okay reopening of schools across Nigeria.

Sani Aliyu of Nigeria Presidential Taskforce on Covid-19 announce for Abuja say make state goment dem plus school administrators dem make plans and prepare for di full reopening of schools for di kontri.

Some private universities for Nigeria don react to di announcement of di goment say make school dem prepare to resume.

Di universities wey tok wit BBC Pidgin on Friday want di goment to dey specific enough as dem still dey wait for goment to know wen dem go reopen dia schools to students again.

Nigeria get more than 75 private universities, according to Nigeria University Commission and many of dem bin close down since March 2020 wen di Federal Ministry of Education bin shut down all schools sake of di coronavirus outbreak.

School resumption date

Wia dis foto come from, Ayobami Owolabi/Facebook

Wetin we call dis foto, 16th Matriculation Ceremony of Lead City University, for February 2020 just before di coronavirus lockdown

Di tok tok person of Lead City University, Dr. Ayobami Owolabi, wey follow BBC tok, say na pressure from private universities make di goment make di fast announcement and add say dem no know wetin dey cause delay as dem don dey ready to resume.

Di Nigerian goment on Thursday say state goment dem plus school administrators make dem make plans and prepare for di full reopening of schools for di kontri but di private schools say dat announcement no dey enough.

"We don dey hear prepare to resume since," Dr Owolabi tell BBC Pidgin. "We no close di university by oursef, dia was memo from di National Universities Commissions, wey come from di federal goment, say make we close down school. Since dia was memo, di reopening must come from dem. Dem ask us to close down and dem must tell us to open."

School resumption date

Wia dis foto come from, State House

Wetin we call dis foto, Wen dem bin President Buhari as as Grand Patron of the Nigerian Academy of Engineers for Nov. 2016

Also, Babcock University say dem don dey ready to resume but dem dey wait for specific date from di goment before dem open. "We dey wait for futher pronouncement from di goment" di tok tok person, Joshua Suleiman, tell BBC Pidgin.

E add say di school don abide by all di regulation of health authorities.

Covenant University tell BBC Pidgin say di management of di school dey do meeting today Friday, 4 September, 2020, to decide wen dem go reopen dia school to students again and say by tomorrow dem go know exactly wen dem go resume school. He add say di school don dey ready to resume.

School resumption date
Wetin we call dis foto, University library for Nigeria

Di administrative staff of Afe Babalola University, Afeez Olaniyi, also say dem dey wait on specific pronouncemnt from di goment.

We dey more ready pass goment schools

Dr Owolabi also say must of di private university dey ready pass di state owned universities as dem do put in place measures to ensure say dia students dey safe wen dem resume school.

"Private universities dey ready pass goment universities wey I no think say dey really ready. I no fit speak for goment universities but private universities don dey ready to resume," Dr Owolabi tok.

School resumption date

Wia dis foto come from, AUN Nigeria

Before di announcements, some universities both private and goment don dey do online classes to complete di semesters inside di 2019/2020 academic calendar.

Latest update from Nigerian private universities

Achievers University, Owo -undergraduate admissions 2020/2021 session dey in progress.

Adeleke University -undergraduate admissions 2020/2021 session dey in progress - Dem add say make all students get certificate of medical fitness from home as dem return back to school, and di medical report suppose be within 24 to 48 hours s di time of resumption.

African University of Science and Technology (AUST) Abuja - Admission into 2021/22 Session start for July 2020

Ajayi Crowther University, Ibadan - second semester online examinations 2019/2020 - go hold Friday, 4 September, and Saturday, 5 September, 2020.

American University of Nigeria, start admission application for August, 2020.

Bells University of Technology, Otta just finish 2019/2020 Second Semester online examination.

Benson Idahosa University don start admission into 2021/22 Session.

Bingham University don start screening of fresh students into 2020/2021 academic session.

Chrisland University, Abeokuta conclude dia 2019/2020 second semester for August 2020 and don start screening of fresh students into 2020/2021 academic session.

Covenant University Otta, admission process into di University go continue on Monday, September 7, 2020, and dem go screen applicants wey wan enta di University. Di Covenant University Scholastic Aptitude Screening (CUSAS) na compulsory screening test wey di institution dey do for students. E dey always happun once a year before di beginning of di academic year. Dis year own go be online to obey di social distancing protocol wey dey on ground sake of Covid- 19.

Evangel University, Akaeze di Registrar John Nwagboso say di University go resume for revision and second semester examinations as soon as di National Universities Commission or di federal goment announce say schools fit reopen.

Godfrey Okoye University, Ugwuomu-Nike - Enugu State don start admission into 2020/21 Session.

Lead City University, Ibadan admission into di 2020/21 session dey open.

Madonna University, Okija First semester 2019/2020 examination for year one students go be online di same platform dem dey use for online lectures and di exam go start for 14 September and end on 22 September, 2020.

Oduduwa University, Ipetumodu - Osun State don start admission into 2021/21 academic Session, candidates wey wan change dia university of choice to dis one fit go di campus or visit any of dia screening centres.

Pan-Atlantic University, Lagos Undergraduate programmes - classes go begin for October, 2020.

Rhema University, Obeama-Asa - Rivers State don begin admission into 2021/21 academic Session.

Salem University, Lokoja don begin admission into 2021/21 academic Session.

Veritas University, Abuja don begin admission into 2021/21 academic Session.

Kola Daisi University Ibadan, Oyo State don begin admission into 2021/21 academic session.

Dominican University Ibadan Oyo State don begin admission into 2021/21 academic session.

Clifford University Owerrinta Abia State don begin admission into 2021/21 academic session.

Admiralty University, Ibusa Delta State don begin admission into 2021/21 academic session.

PAMO University of Medical Sciences, Port Harcourt don begin admission into 2021/21 academic session.

Skyline University, Kano don begin admission into 2021/21 academic session.

Trinity University Ogun State don begin admission into 2021/21 academic session.