"Nigerian schools resumption" date inside states wey dey go ahead wit 2020 reopening of schools despite Nigeria Covid 19 warning

A number of state goments dey go ahead wit reopening of schools for Nigeria dis September even though federal authorities don advice for caution.
Nigeria Health minister say COVID-19 still get power to take life and very dangerous while Academic Staff Union of Universities (Asuu) don warn Nigerian goment make dem neva reopen higher institutions now.
However a number of state goments don announce full reopening of schools to begin 2020/2021 new academic calender for both universities, colleges, secondary and primary schools.
LAGOS
Di Lagos State goment don release dia plan for di resumption of di 2020/2012 academic session. According to di state Chief Press Secretary to Lagos State Governor, Gboyega Akosile, di commissioner for education say di state go allow make JSS 3 student to resume so dat dem go fit prepare for di coming Basic Education Certificate Examination wey go allow dem go SS 1. Di exam go start on Monday, October 6 and go end October 12, 2020.
Di state say dem go announce wen primary 6 students go write dia examination, as well as wen oda classes go resume.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Exit schools on August 4
Primary and secondary schools reopens September 21st
Tertiary institutions reopens September 14 2020.
End of Di one wey oda users dey read well well
OSUN
Exit classes on since August 4th
Primary and secondary schools - September 21 to October 30 2020 for third term.
New session first term November 9th to January 22, 2021 with short break in December 2021.
Second term February 1 to April 9th 2021.
Third term April 26 to July 23, 2021
Tertiary institutions 21 September 2020.
OYO
Exit classes on since August 4th.
Third term canceled by the goment. Promotion assessment go dey based on first and second term performance.
Fresh session go start September 21 to July 30, 2021.
First term - September 21 to December 18 2020.
Second term January 11 to April 9 2021.
Third term May 3 to July 30 2021.
Tertiary institutions to resume September 21, 2020.
OGUN
Exit classes only since August 4.
Condition - to take final exams
ONDO
Exit classes on since August 4th.
EKITI
Only exit classes on since August 4th.

Wia dis foto come from, OTHER
BAYELSA
Frome di State Ministry of Education, Primary 6: go resume on 7 September, 2020
JSS3 don resume to prepare for Basic Education Certificate Examination
SS3 don resume dey write WAEC exams
DELTA
Primary schools for Delta State to resume academic activities afta goment ask primary six pupils to resume school on Wednesday, 16 September, 2020.
All primary school teachers for di state go resume duties on Monday, September 14, 2020, according to infomate by di state Commissioner for Basic and Secondary Education, Mr. Patrick Ukah.
Students go begin revision immediately dey enter school.
JSS3 go resume 8 September, 2020
SS3 already don resume dey write WAEC SSCE.
Ministry of Higher Education say Universities and oda Higher education fit resume 21 September, 2020
RIVERS
Fom di state Ministry of Education, Primary 6: No date yet for resumption
JSS3: don resume school to prepare for Basic Education Certificate Examination
SS3: Don resume dey write WAEC
Meanwhile online classes dey go on since do Covid-19 lockdown begin for all classes for Radio and Television stations
Exit classes have been in school since August.
Primary, Secondary, Tertiary institution to resume on the 14th of September 2020.
KOGI
Even di Kogi state goment for north-central Nigeria on Tuesday, announce di reopening of schools at all levels on 14 September, 2020, including Primary, Secondary and Tertiary institutions inside di state, according to Wemi Jones di state Commissioner for Education, Science and Technology.
BENUE
Only exit classes don resume school. Goment neva comot plan and date for total reopening of schools.
NIGER
Exit classes don start school since August
Goment plan to reopen school neva dey clear.
KWARA
Only exit classes on since August 4th.
ABUJA - FCT
Exit classes except primary six don resume since August
But no date yet for full resumption of school until federal goment give go ahead.













