WAEC examination time table: Nigeria Unity Schools no go do di West Africa Examinations Council 2020 assessment

Nigeria goment say Unity schools no go take part in dis year West Africa Examination Council until e dey safe to resume.
Minister of Education Adamu Adamu advise WAEC and state goments to no reopen schools until e dey safe to do so.
Adamu ell tori pipo dis one afta di virtual meeting of di federal executive council.
On 30 June, 2020, di presidential taskforce on coronavirus bin give green light for graduating classes for Nigeria to reopen even as dem extend phase two of di lockdown.
Oga of di task force, Boss Mustapha, bin say classes like Primary six, JSS 3 and SS 3 go open again in order to prepare for dia graduating exams dem.
Di PTF bin advise safe re-opening of schools to allow students for graduating classes to resume in-person in preparation for examinations.
Oga Mustapha bin say secondary and tertiary schools go remain closed except JSS 3 and SSS 3, while day care and primary schools go remain closed till further notice except for primary six.
Di advise na for all schools to try to do intensive revision exercise for those wey dey prepare for exams and di schools dem gatz follow and adapt to di Covid 19 guidelines.
End of Di one wey oda users dey read well well
But Adamu wey appeal to states wey don announce di resumption of school for dia states to reconsider dia position so as not to endanger di lives of di students.
"Our schools go only open wen we belive say e dey safe for our children and wen di situation dey right".
"We no go open soon for any reason, unless e dey safe for our children, even WAEC. WAEC no go determine for us wetin we go do. Schools go remain closed". Adamu tok.
As at 7th June, 2020, Nigeria get total of 29789 confam coronavirus cases, 669 pipo don die while 12108 don dey discharged.
You fit like to read dis beta tori dem:
- Abandon sick student of KNUST SHS die sake of Covid-19 fear - See what we know so far
- See wetin hapun for Lagos local airport as flights resume today - Fotos
- One in evri 100 pipo get bipolar disorder - Dis na wetin you need know about dis mental health condition
- After EFCC chairman, Umar na di most senior cop for Nigeria corruption police
- See how Dubai don beef up internet security afta dem arrest Hushpuppi
- How English Premier League table dey look like now
- See di prison wia FBI keep Hushpuppi
- Jeff Bezos fit become di world first trillionaire













