Ibrahim Magu EFCC boss: Mohammed Umar na im be di most senior for Nigeria corruption police now

Mohammed Umar Abba fit be EFCC Chairman

Wia dis foto come from, Mohammed Umar Abba

Wetin we call dis foto, Mohammed Umar Abba na im be di pesin wey dey right.
Read am in 1 mins

Mohammed Umar Abba na im be di most senior ranking officer inside Nigeria corruption police office after Ibrahim Magu chop suspension as di acting chairman of EFCC.

Nigeria local media don dey report say oga Umar Abba wey be deputy commissioner of police and Director of operations for di agency na im dem don name as Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), BBC Pidgin also don confam di tori.

However, DCP Mohammed Umar Abba wey come from Kano state for northwest Nigeria go dey in charge of EFCC from now on until further notice, according to di Office of di Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Abubakar Salami.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

E no dey clear when dem born Mohammed or wia e attend im school before e join police but na pesin wey don stand in for former chairmo Magu for different events wey e represent am.

Last year, na Mohammed represent Magu for di EFCC/FBI media briefing for Lagos wey dem tag operation rewired wey returned plenti money wey Nigerian fraudsters steal from Americans and dem also arrest 167 Nigerians.

Also anoda thing about Mohammed e bin dey at di forefront of EFCC gbege with former senate President Bukola Saraki.

Na him sign letter wey ask Kwara state goment to supply EFCC with all cash books, payment vouchers and contract award letters wey Saraki sign during im time as govnor.