When will WAEC 2020 start: West Africa Secondary School Leaving Certificate Examination don cancel - Dis na wetin we know

Schools don reopen for Oyo state
Wetin we call dis foto, Schools don reopen for Oyo state

Over one million candidates don register for di West Africa Secondary School Leaving Certificate Examination wey suppose begin on August 3 to September 5 2020 as di West Africa Examination Council for Nigeria bin don announce on Monday and dem say nothing go change.

But di federal goment don come out to say Unity schools no go take part in dis year West Africa Examination Council until e dey safe to resume.

Minister of Education Adamu Adamu advise WAEC and state goments to no reopen schools until e dey safe to do so.

Adamu tell tori pipo dis one afta di virtual meeting of di federal executive council.

WAEC bin don tok say dem no go lower dia standards sake of coronavirus and because students get short time to prepare for di examination. As e be , e neva dey clear if state schools wey done resume go go ahead wit di exams, as WAEC neva come out to reverse dia decision afta wetin goment tok.

BBC Pidgin bin don tok to di Head of West Africa Examination Council for di Nigeria Office, Patrick Eraghan on tuesday and im warn students wey wan write di examination make dem no use di excuse say dem no dey prepared for di exam to take cheat.

"I must warn all schools and candidates to bone any kain examination malpractice. Say you no prepare no be excuse to cheat. Di standards wey we get before na im we still dey follow. No tink say because of di coronavirus anytin go change. E go be double wahala for any candidate wey dem catch sake of examination malpractice as on top di stress im face to write di exam, e no go still collect result."

We don reach out to am again afta goment tok but e neva respond.

Students for inside classroom

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Students for inside classroom

Dis na wetin dem wan schools to provide:

Oga Patrick say e no easy to reach dat date as dem gatz consult wit di oda five African kontris wey also dey write di exam to arrive at dat date. He explain say dem suppose don write di exam for April but postpone sake of coronavirus. And as e be so, schools must to dey ready and make different different arrangements for di students we go write di exam. Part of dem be say:

  • Schools must provide wash hand buckets wit running water, soaps and hand sanitizers.
  • They must provide thermometer hand-gun to check pipo temperature.
  • Compulsory face mask for examination functionaries , dis na di supervisors, invigilators, inspectors candidates and school officials.
  • Dem must wash dia hands all di time di examination go hold.
  • Students go sit 2 meter apart to maintain social distancing.
Oyo state government reopen schools
Wetin we call dis foto, Oyo state government reopen schools

Candidates, teachers and stakeholders worry

Di President of di National Association of Private Schools (NAPSS) Olusola BankoleMrs Bankole say she "dey fear make di exam body no record mass failure dis year because two weeks no dey okay to prepare students wey neva enta classroom for a long time to write dat kain major examination."

She say most private schools for Abuja dey ready for di exams and don put all precautionary measures in place according to di guidelines of di federal goment but parents must provide di personal protective gears for di students.

She explain say na public schools still dey hold dem and goment neva put measures in place for dem to fit reopen.

Wit less than three weeks to write di examination, stakeholders for di kontri education sector dey worry if candidates go fit perform well for di examination as schools don dey lockdown for more than three months sake of di coronvirus pandemic.

Di NAPPS presido say make pipo no expect any fantastic results from WAEC, as quality time no dey for di children to learn and prepare for di exams.

She say dis na why goment suppose make quality education priority. She say now dem wan rush children wey neva enta classroom for di past three months to begin write exam in di next two weeks, di fear alone go destabilize di students.