School resumption date in Nigeria, oda African kontris and lockdown calendar for Secondary, Primary and Universities to re-open

Latest update on school resumption in Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Latest update on school resumption in Nigeria
    • Author, Olaronke Alo
    • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin, Lagos

Federal goment update on school resumption date in Nigeria be say as from Monday 29 June, 2020 pipo wey wan write exams for classes like Primary six, JSS 3 and SS 3 go open again in order to do revision ahead of dia graduating exams dem.

Nigeria Presidential Taskforce on Covid-19 na im announce di update on school resumption afta months of lockdown sake of coronavirus palava for di West African nation.

However, all oda Secondary and tertiary schools (public and private) to remain closed, until further announcement, goment authorities add.

Since March 26, all schools for Nigeria bin close in order to stop coronavirus spread. Di good news be say no be only Nigeria dey gradually ease lockdown measures.

See oda African kontries wia Secondary, Primary and Universities reopen

Earlier in di day, Tanzania become di first kontri to allow pupils go back to school since di outbreak of coronavirus for East Africa region.

Dis dey follow di directives wey President John Magufuli give some weeks ago. Dem bin suspend all schools on 17 March, 2020 soon afta di outbreak of COVID19.

Authorities don give schools guidelines wey dem go use prevent anoda outbreak and also protect pupils from di virus

Guinea

Goment of Papua New Guinea allow school to reopen on 4 May.

World Health Organisation, WHO bin work wit partners to assist di goment to put measures in place to make am possible for schools to reopen safely.

For di kontri wey don alredi dey battle di outbreak of Ebola, equipment for infection control and hygiene, most eapecially soap for hand washing, disinfectants for classrooms, and thermometers for measuring children's temperatures don already dey for di school system

South Africa

Schools for South Africa resume on 8 June even as some parents protest say make goment neva open school

Cameroon

For Cameroon, primary and secondary school students for dia final year begin return to class on Monday 1 June.

Di kontri Minister of Secondary Education, Pauline Lyonga, say di move na to help children catch up on missed lessons and assist parents wey dey gradually return to work.

Among the measures schools in the West African country must observe are temperature checks, compulsory mask-wearing, customized school buses and designated routes to classrooms to prevent the gathering of crowds.

Ivory coast

Among di earliest kontris to reopen dia schools for Africa na Ivory Coast, dem resume learning on 25 May.

However, oda African kontris decide to postpone di reopening of schools, dem tok say cases of coronavirus dey increase.

Senegal

For Senegal, President Macky Sall postpone di reopening of schools wey dem initially schedule for 2 June afta some teachers test positive to coronavirus for di kontri southern Ziguinchor region.

Uganda

President Yoweri Museveni tok say di kontri neva readi for di resumption of classes.

"I bin dey tok about opening schools afta 4 June, but we don further study dis wit di scientists and di eventual decision na to delay.

We get 1.4 million children in dia candidate classes and finalists. We no get enough testing kits for testing those numbers everi two weeks," Museveni tok during one televised national address.