N-Power 2020 recruitment portal, wen NPower registration go close and oda facts you must know before, afta you fill di application for employment & complete online web portal in Nigeria

Wia dis foto come from, @npower_ng Twitter
- Author, Fiona Equere
- Role, BBC News Pidgin
- Read am in 2 mins
Federal goment of Nigeria don extend di N-Power Batch C online application by two weeks.
Di online application wey bin start on Friday, June 26, 2020 supposed don end on Sunday, July 26, 2020.
But according to statement by di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, di extension na to give evribodi chance to register online and dem wan also consider any challenge wey some pipo fit face as dem dey try get access to di registration portal.
Dis extension dey come as goment say dem don receive more dan five million applications so far.
"Di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development say di extension dey necessary to give all di applicants equal opportunity", di statement tok.
As at 27 June, 2020, ova five million Nigerians don apply for di goment youth empowerment programme, wey open at exactly 11:45PM on Friday 26 June.
According to di authorities dem say na 400,000 beneficiaries dem go collect from dis current application pool.
N-Power, na job creation and empowerment programme of National Social Investment Programme of Nigeria goment to help young pipo get work.
End of Di one wey oda users dey read well well
If you dey reason to apply or you don already apply, dis na wetin you suppose know.

Wia dis foto come from, @npower_ng Twitter
Before you apply for NPower registration
- To register for N power remember say dis scheme na for Nigerians wey no get work and no get any source of income at all.
- NPower say if you application dey successful you go receive confirmation email.
- If you don benefit from di scheme before you no qualify to apply again. Oda young Nigerians need di opportunity to help make dia life better, na wetin N-Power tok.
- You must be 18 to 35 years of age
- You must get valid ID card (International Passport, National ID, Permanent Voters Card or Valid Drivers' Licence) and get active BVN (Bank verification Number)
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Afta you complete N Power online registration web portal

Wia dis foto come from, N-Power 2020 registration
- No forget to check your email SPAM folder for di confirmation email if you register because sometimes na dia e dey go.
- N-Power na programme wey get tenure alias time frame and you go exit afta di programme end.
- If you get issues wit your registration N-Power dey aware and dem say dem go resolve all di issues dem.
- If you pick a programme no be guarnatee say you dem go select you for di programme.
- Dis one dey very important, keep your ID safe













