School resumption, flight resumption, interstate movement and lockdown in Nigeria new rules

Buhari and PTF members

Wia dis foto come from, Twitter/@BashirAhmed

    • Author, Faith Oshoko & Dooshima Abu
    • Role, BBC Pidgin

Lockdown in Nigeria new rules give way for school resumption, flight resumption and interstate movement.

Federal goment give green light for graduating classes for Nigeria to reopen even as dem extend phase two of di lockdown.

Oga of di task force, Boss Mustapha, say classes like Primary six, JSS 3 and SS 3 go open again in order to prepare for dia graduating exams dem.

Dis na also as im say goment don lift di ban on interstate travel only outside curfew hours with effect from July 1st, 2020.

Di head of di Presidential taskforce on Covid-19 Boss Mustapha make di announcement on Monday for di daily coronavirus update.

Oga Boss say, goment approve di extension of di lockdown ease phase two by anoda four weeks with slight modification.

Dis dey come on top di rise in new cases of coronavirus for di kontri. E don pass 24,000.

President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Twitter/@laurastar

Highpoints of di PTF briefing

  • Buhari approve di phase two of di easing of di lockdown extension for four more weeks
  • National curfew from 10pm to 4am still dey on ground
  • Safe re-opening of schools to allow students for graduating classes to resume in-person in preparation for examinations
  • Secondary and tertiary go remain closed except JSS 3 and SSS 3
  • Daycare and primary schools go remain closed till further notice except for Primary six.
  • All schools must try to do intensive revision exercise for those wey di prepare for exams and di schools dem gatz follow and adapt to di covid 19 guideline
  • All schools must follow di six recommended steps wey di ministry of Education put in place.
  • Funerals and weddings go dey limited to 20 pipo
  • Artisans and hairdressers wey own dia own workshop go fit operate
  • Cinema dem, night clubs and oda jolly places including gyms go still dey closed
  • Di face mask law and curfew law still dey for ground without any changes.
  • Offices must maintain 75% capacity
  • Working hours for goment offices go dey from 9-2pm
  • Safe reopening of domestic aviation services as soon as practicable
  • Dem go allow pipo to start to dey travel from state to state but only outside of di curfew hours.
Buhari relax Lockdown in Nigeria

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Lockdown in Nigeria

For Interstate transport to happun all di parks gatz get

  • Place wia passengers dem go wash dia hands
  • Dem must enforce everibodi wear masks
  • Dem go do temperature checks for every passenger and dem go get crowd control for dia parks
  • Buses go only cari fifty percent of dia capacity
  • Dem must keep dia windows open
  • State goments dem gatz inspect dia various park and make sure say dem dey follow di laid down procedure.
  • Restriction of movement go dey for local goment wey get plenti coronavirus cases for di kontri.