Governor Ifeanyi Okowa of Delta State, im wife Edith Okowa don test positive for Coronavirus COVID-19

Delta State Governor Ifeanyi Okowa

Wia dis foto come from, @GovIfeanyiOkowa

Govnor Ifeanyi Okowa of Delta State don catch coronavirus.

Di Delta State Govnor announce on Wednesday morning say him and im wife Edith Okowa test positive for Covid-19.

Di Delta state Govnor daughter bin test positive for coronavirus five days ago.

Di govenor and oda members of im family bin don enta self-isolation since dia pikin catch di virus.

Last week, di gonvor bin go Edo State to rejoice wit Govnor Godwin Obaseki as im join di opposition, People's Democratic Party (PDP).

Gov Okowa wit Gov Obaseki for Edo State

Wia dis foto come from, Twitter/ @IAOkowa

Im also visit projects sites for di state wey dey under construction.

We go give una more update later.