Kemi Adeosun: Me sef shock say my NYSC certificate na fake

Kem Adeosun

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 2011, Kemi Adeosun even use dis same certificate become Finance Commissioner for Ogun State south west Nigeria, according to Premium Times
Read am in 2 mins

President Muhammadu Buhari on Friday accept di resign letter of Minister of Finance, Kemi Adeosun and approve anoda minister Zainab Ahmed to dey in charge of finance ministry.

Dis dey come more dan two months afta one Nigerian tori pipo first comot di allegation of fake certificate on 7 July, wia dem suggest say even National Assembly know about di mata but decide to close eye.

Inside her resign letter on 14 September, di immediate former minister of finance say she sef shock when she find out say di NYSC exemption certificate wey she don dey carri up and down, na fake.

Adeosun say dis na because dis na di same NYSC certificate wey she take work for Ogun State House of Assembly in 2011 and also use am in 2015 for Directorate of State Services (DSS) clearance. Even National Assembly sef screen am and no see di certificate get comma.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Nigerian investigation tori pipo Premium Times go see dis as victory because dia allegation against di minister end up to be true - if to say na lie dem lie ontop Adeosun head, na dem for dey inside hot soup as she fit decide to carri dem go court.

E dey important to point out say in all di seven paragraph wey Adeosun write inside di resign letter, she no mention Premium Times, or di alleged padi-padi with di National Assembly.

Kemi Adeosun become Nigeria Minister of Finance for November 2015 wit dis same certificate, according to Premium Times

Wia dis foto come from, @HMKemiAdeosun

Wetin we call dis foto, Kemi Adeosun become Nigeria Minister of Finance for November 2015 wit dis same certificate, according to Premium Times

Anoda pipo wey go see dis as victory na those wey don dey call for Oga Buhari to stand by im tok of 'zero corruption' and sack Adeosun. Dis sack no eventually happun and Adeosun use di opportunity to thank Buhari for im "patience".

"Your Excellency... make I commend your patience and support, during dis long search for di truth in dis mata," tok Adeosun for her letter.

Now wey di position of permanent Minister of Finance dey open, some Nigerians wey don accuse Oga Buhari of nepotism - wen im appoint Yusuf Bichi wey be northerner as DSS Oga - go dey look to see who di president go nominate for di job.