Experts explain health benefits of garri and wetin too much consumption fit cause

Garri

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Kano
  • Read am in 3 mins

Garri na one kain flour wey dem dey make from cassava tubers, and pipo for Nigeria and oda parts of West Africa dey chop am well-well.

Some pipo dey use am make eba or soak am inside water join am wit milk, sugar, and groundnut.

E get pipo wey believe say too much of garri fit affect pesin eye and dem believe say e also get oda health implications.

Na dis kain tok-tok wey dey go round from pipo make BBC News Pidgin sidon wit health experts like Dietitian Sa'adatu Sulaiman and Dr Abdulmalik Ibrahim wey dey work for Gwarzo General Hospital for Kano, to know about di benefits and health implications of too much consumption of garri.

Dietician Dr Sa'adatu Sulaiman tell BBC News Pidgin say "Pesin wey dey chop garri as balanced diet, e fit give im body plenty beta tins."

On di oda hand, Dr Abdulmalik tok say garri fit get implications but only if dem no process cyanide wey dey inside well.

E tok say, "Garri get one chemical wey dem dey call cyanogenic wey be dangerous poison for health."

Health benefits of garri

Dietician Sulaiman tok say If pesin chop garri as part of balanced diet, e fit give di body plenty beta tins:

  • Plenty energy: Garri get plenty carbohydrate, e dey give quick energy for evriday waka.
  • Low fat: Garri no get plenty fat at all. E good for pipo wey dey try reduce fat for dia body. But e good make pesin still chop garri wit healthy fat like fish or groundnut to balance am well.
  • E no get gluten: Becos say garri na from cassava, e no get gluten. So pipo wey dia body no dey gree gluten or wey get celiac disease fit chop am.
  • Fiber dey inside: If dem no process garri too much, e still get small fibre wey fit help belle work well and keep gut healthy. But e no get as much fibre like whole grains or vegetable.
  • E easy to add vitamins: Some garri wey dem dey sell don get vitamin like vitamin A added to am to help pipo wey dia body dey lack some nutrients. Garri dey go well wit food wey get protein like beans or fish to make am more rich.
  • Resistant starch: Some research tok say food wey come from cassava like garri get resistant starch wey fit help belle by acting like prebiotic – but dis one depend on how dem process di garri.
  • Limitations: Garri no too get protein, or vitamins and minerals like iron, zinc or calcium. If pesin dey chop only garri witout beta food to support am, e fit make body lack some nutrients wey body need, and e fit affect health.

How garri fit affect eye

Dr Abdulmalik tok say if dem no process garri well, especially if na from bitter cassava, e fit cause cyanide poison wey fit make pesin dey vomit, feel dizzy, or even get nerve wahala wey fit affect how pesin dey waka.

Some pipo dey tok say garri dey affect eye, Dr Abdulmalik say dat one fit happun only if pesin dey chop too much garri or if di garri no done well becos of small cyanide wey still remain inside.