South Africa shock tournament favourites Morocco as Hakimi miss penalty

Wia dis foto come from, Getty Images
South Africa produce one of di shock of di 2023 Africa cup of Nations as dem defeat tournament favourites Morocco 2-0 to seal qualification to di quarter-finals.
Evidence Magkopa strike on 57 minutes put Bafana Bafana in di lead to di surprise of many inside di San-Pedro stadium.
Morocco bin get chance to equalise on 85 minutes from di penalty spot afta di ref and VAR judge say Mvala use im hand stop El Kaabi goalbound shot.
But Hakimi blast im kick onto di crossbar and see South Africa maintain dia advantage.
Wit five more minutes before di end of di match, Morocco go down to ten men as Amrabat receive straight red for foul on Mokoena.
From di resulting freekick, Mokoena double South Africa lead wit a wonderful strike wey fly past Bono into di net.
Morocco wey become di first African side to reach di Semi-final of a World Cup last year come into dis tournament as big favourites.
Dem top dia group wit seven points but now don fall wen e matter most.
End of Di one wey oda users dey read well well
Witout di injured Sofiane Boufal and Hakim Ziyech, coach Walid Regragui make some changes to im starting lineup but di Atlas Lions struggle to create much against South Africa.
Instead na Bafana Bafana wey go close to scoring on 16 minutes wen Bono dive low to push out Mokoena shot.
Di boys from di rainbow nation den open di scoring just before di hour mark as Zwane knack through pass to Magkopa wey control di ball well before im shot di ball low beyond Bono.
Morocco send on striker El Kaabi to try and find di equaliser and na di substitute shot wey Mvala use im hand block create di golden opportunity. But Hakimi penalty hit di crossbar to wild cheer by di supporters of South Africa.
Wit minutes into stoppage time, Morocco go down to 10-men. Amrabat wey be di last man bring down Mokoena. Di ref bin show am second yellow card but later upgrade am to straight read as im deny an obvious goalscoring opportunity.
From di freekick Mokoena rubber stamp South Africa progress to di quarter-finals as im shot curl past Bono into di net.
South Africa go party dis night but afta tins settle, dem go meet Cape Verde for di quarter-final. For Morocco, dia time for Ivory Coast don come to an end.
Recap of how di match go
Second half
FT: Morocco 0-2 South Africa
90+12 mins - El Kaabi rise high to head a nice cross low into di arms of Williams. South Africa don almost reach di quarter-final.
90+9 mins - One more minute now to confam Morocco elimination.
90+5 mins - Goal for South Africa! Tebboho Mokoena score di freekick.
Morocco 0-2 South Africa
90+2 mins - Red card for Amrabat. Di midfielder receive e second yellow card as im bring down Mokoena wey bin dey race towards goal.
O wait, VAR don ask di ref to go check am. Di ref upgrade di yellow to straight red card.
90 mins - Dis two teams go play 10 more minutes as stoppage time. South Africa need to find anoda goal or han on while Morocco need equaliser to send dis game into extra-time.
87 mins - Substitution: Monare don enter di game, Sithole don leave di pitch
85 mins - Hakimi to take and di right back don miss di penalty. Im waya di shot hit di cross bar.
Morocco 0-1 South Africa
83 mins - Afta VAR check di ref say PENALTY and e show Mvala yellow card.
81 mins - Drama for San-Pedro stadium. El Kaabi shot inside di area hit Mvala arm. Di Moroccans want penalty and dem crowd di ref, e wave play on but later stop di game to go check VAR.
80 mins - Maseko try to dribble Hakimi inside di area den im go down dey find penalty. Di ref warn am against simulation.
75 mins - El kaabi rise high to head anoda good chance for Morocco over di bar. Amrabat na im bin cross di ball wey di striker head over.
Morocco make anoda substutition - Mazraoui OFF, Attiyat Allah ON.
74 mins - Morocco win cornerkick, di fans dey cheer dem on. South Africa clear di cross and di ball hit di back of Lepasa. Morocco want penalty, di ref blow play on.
72 mins Anoda change for South Africa - Lepasa enter di game, Magkopa don go siddon for bench.
69 mins - South Africa coach don take off Zwane wey provide di assist for Magkopa goal. Maseko don take im place.
Meanwhile Morocco send on anoda striker, El Kaabi don enter na Ezzalzouli comot.
66 mins - Zwane try to find Tau wit anoda fine through pass, Aguerd read di ball well to clear di danger.
64 mins - Yellow card for Amrabat.
59 mins - Now Morocco respond wit a shot from Ezzalzouli wey Williams push out.
Morocco make two changes: Amallah and Adli OFF, Harit and Saibari ON.

Wia dis foto come from, Getty Images
57 mins - Goal for South Africa! Evidence Makgopa don score for Bafana Bafana. Di striker manage to stay onside as im receive di ball from Zwane before im slide di ball low beyond Bono.
Morocco 0-1 South Africa
50 mins - Ezzalzouli produce good dribbling skill as im go past two South Africa players before im go down inside di box. Di Moroccan players and dia bench scream for penalty, di ref no give am. VAR sef no tell di ref to go check di monitor
48 mins - Ounahi and En-Neysri combine well side South Africa penalty box, Ounahi try to volley di striker return pass but di shot go over di bar. Good start for Morocco to di second half.
46 mins - Second half don resume wit di game goalless. One team must win dis one.
First half

Wia dis foto come from, Getty Images
HT: Morocco 0-0 South Africa
45+5 mins - Mokoena try anoda long range shot as Morocco defence look super tight to break down, im shot fly wide.
Dat na di last action of dis game as di ref don blow im whistle for half-time.
45+1 mins - Selim Amallah wit anoda chance for Morocco...di midfielder drag im shot wide. We don enter inot four minutes of added time.
44 mins - Adli nearly put Morocco ahead as im dribble im way into South Africa eighteen-yard box, di forward fail to shoot as im final touch dey poor.
39 mins - South Africa look to slice open di Moroccan defence wit a through pass from Zwane, di ball reack Makgopa but im don dey in offside position.
36 mins - Now Kekana don collect im own yellow card for pulling back En-Neysri wey bin dey run towards goal.
33 mins - Play don resume now and Morocco put di ball inside di net. Di fans celebrate but di ref bin don blow im whistle before Morocco score, Mazraoui bin dey offside.
29 mins - Modiba don receive yellow card as im bring down Hakimi wey bin don run past am. Di ref don signal for cooling break, Hakimi still dey receive treatment but e look like say im go kontinu di match.
25 mins - Morocco now dey control di ball possession, 53%, but dem never get any shot on target so far.
19 mins - Afta some delay due to problem wit di referee communication device South Africa finally take di cornerkick. Mvala head am just over di bar. Close!
16 mins - Good save by Bono! Mokoena decide to try im luck from distance as im shoot hot shot towards goal, Bono dive low to save di ball go out for cornerkick. From di corner, Morocco clear di cross go out for anoda cornerkick.
14 mins - Ounahi wit dangerous cross into di area for Morocco, im cross fail to find any player.
9 mins - Morocco creat di first chance from a freekick. South Africa fail to clear di ball and e fall for En-Neysri inside di box, di striker shoot straight into Williams. Di flag later go up for offside.
7 mins - Amine Adli lose di ball inside South Africa half and di Bafana Bafana mount quick break but Tau left foot cross to find im teammate go straight to Bono wey dey Morocco post.
3 mins - South Africa buildup from di back wit some nice passes, Mokoena loop am over di Moroccan defence to fee Makgopa. Di striker no dey offside but e no control di ball well as Saiss fall back to clear.
1 min - So afta both teams sing dia national anthems and shake hands, dis Last 16 match between Morocco and South Africa don start.
Morocco vs South Africa lineup
Morocco XI: Bounou, Hakimi, Aguerd, Saiss, Mazraoui, Amarabat, Ounahi, Amallah, Ezzalzouli, En-Nesyri, Adli.
South Africa XI: Williams; Mudau, Kekana, Mvala, Modiba; Sithole, Mokoena; Morena, Zwane, Tau, Makgopa.














