Lookman double set up quarter final game between Nigeria and Angola for Afcon 2023

Victor Osimhen celebrate Nigeria win over Cameroon

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigeria don enta di quarter final of di Afcon 2023 wit dia two nil victory over dia neighbours Cameroon.

Di match wey hold for Stade Felix Houphouet-Boigny in Abidjan see two teams wey dey desperate to prove a point.

Na Atlanta forward Ademola Lookman score di two goals for di Super Eagles - wit one goal in each half.

Lookman goals come from an impressive team effort of di Nigerian squad and di super performance of dia talisman Victor Osimhen wey put pressure on di Cameroonian denfence.

Na Oumar Gonzalez di Indomitable Lions give di work to mark Osimhen - work wey di Al-Raed defender do well.

But di Super Eagles try find oda ways of scoring. Dem also keep dia third clean sheet for di tournament.

Dis victory over Cameroon don set-up a Quarter final game wit Angola. Di Match go happun on Friday and e go be anoda ogbonge test for di Nigerian team.

Second Half

Nigeria vs Cameroon

Wia dis foto come from, Getty Images

90+10mins: FULL TIME Nigeria 2-0 Cameroon

90+6mins: SUBSTITUTION. Onuachu and Osayi come for di Eagles

92mins: SUBSTITUTIOn. Ekambi enta for Cameroon

90mins: 10mins added time

Nigeria 2-0 Cameroon

89mins: GOAL! Ademola Lookman double am for Nigeria

86mins: YELLOW CARD for Simon Moses for foul on im opponent.

84mins: Ola Aina shot deflect go corner for Nigeria

81mins: SUBSTITUTION. Uzoho enta for Nwabali. Kenneth Omeruo enta for Zeidu

80mins: SUBSTITUTION. Cameroon star man Vincent Abubakar enta for Gonzallez

Nigeria 1-0 Cameroon

75mins: Both teams dey take cooling break

71mins: Georges-Kevin N'Koudou give dangerous inswinging cross from di right.

Nigeria keeper Stanley Nwabali send di ball clear wit a strong punch.

67mins: Alex Iwobi almost send Victor Osimhen clear inside di Cameroon penalty area. Nouhou Tolo do well to stop di danger behind wit im leg.

63mins: Oumar Gonzalez get plenty work wit di duty of marking Osimhen.

Di Al-Raed defender be like say e don dey succeed.

60mins: Moses Simon make good run from di flank and try to find im man. Defender block am

57mins: Cameroon don dey mount too much pressure on top Nigeria

55mins: Ademola Lookman hit di free kick too much. Ball go high

52mins: YELLOW CARD for Wooh sake of foul on Frank Onyeka. Free kick for Nigeria

50mins: E be like say Nigeria don improve from wetin pipo see dem play for dia group stage games

48mins: Zeidu take di free kick for Nigeria. Easy catch for Ondoa

46mins: Linesman catch Osimhen on OFFSIDE

Nigeria 1-0 Cameroon

45mins: SECOND HALF DON START

First Half

One colourful graphic wey feature Nigeria striker Victor Osimhen and Cameroon forward Karl Toko Ekambi

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Nigeria striker Victor Osimhen (left) and Cameroon forward Karl Toko Ekambi (right) get one goal apiece for di Afcon finals

45+3mins: Foul on Victor Osimhen as e try to break di opposion defense

45mins: 6mins added time from di 4th official

40mins: Dat goal don put ginger for Super Eagles body

Nigeria 1-0 Cameroon

36mins: GOAL! Lookman tap in di goal from Victor Osimhen pass

31mins: Game don resume wit a long towards Osimhen. Castelleto block am

Nigeria 0-0 Cameroon

30mins: Cooling break for both teams

25mins: Cameroon dey do well wit di ball wit good build-up plays from di middle

22mins: Foul against Nigeria. Cameroon bin pick possesion but Frank Onyeka cause foul

20mins: OFFSIDE! Against Nigeria from a set piece

18mins: Free kick for Nigeria. Foul on Troos-Ekong

15mins: Possession 50.6% to 49.9%

13mins: Game don return to status quo. Both teams dey take dia time

Nigeria 0-0 Cameroon

10mins: DISALLOWED GOAL! Semi Ajayi put Nigeria ahead from a rebound inside Cameroon box but ref say na offside.

7mins: Nigeria get first corner of di game. Good cross by Lookman

4mins: Easy save for Cameroon keeper Ondoa from Osimhen high heading

2mins: Nigeria wit early possession. Di Super Eagles dey try dictate play

Nigeria 0-0 Cameroon

1mins: KIICK OFF

Nigeria vs Cameroon line-up

One graphic detail rivalry between Nigeria and Cameroon

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Cameroon win three Africa Cup of Nations finals against Nigeria, for 1984, 1988 and 2000 - wit di last of those on penalties afta one 2-2 draw

Nigeria Starting 11: Stanley Nwabali, Temitayo Olaoluwa, Zaidu Sanusi, William Troost Ekong, Ajayi Adesewo, Ogochukwu Onyeka, Victor Osimhen, Moses Simon, Alex Iwobi, Ademola Lookman, Calvin Ughelumba

Cameroon starting 11: Joseph Ebogo, Moumi Brice,Christopher Wooh, Tolo Nouhou, Andre Anguissa, Frank Magri, Georges Mbida, Karl Toko Ekambi, Oumar Gonzalez, Jean Castelletto, Jules Ntcham