Kontris wey don lose dia Coaches for Afcon 2023

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 2023 Africa cup of nations don serve some shocking results for di group stage.
Ogbonge teams wey get reputation don suffer for di tournament, in fact some of dem don crash out at di group stage.
Oda teams, wey no get experience for di tournament don dey shine wia dem dey discipline some of di football kontris.
But even bifor di competition go end, some of di kontris don sack dia coaches, oda coaches don resign.
Football sabi pipo say by di end of di tournament many more coaches go leave dia job.
Algeria say bye-bye to coach Djamel Belmadi

Wia dis foto come from, Getty Images
Di latest coach wia lose im job na Djamel Belmadi.
Algeria don crash out of dia second successive Afcon
For di tournament for Ivory Coast, na minnows Mauritania wey cause dia exit wit a 1-0 result.
End of Di one wey oda users dey read well well
President of di Algeria football federation Walid Sadi don tok say “I meet wit Djamel wia we don reach agreement say make we dissolve di association.”
“We tank Djamel for evritin im don do for di team wia we wish am well.”
Sadi add say dia tournament don end wit “bitter exit”.
Algeria fans don vex afta dia team crash out of di tournament wia some of dem try attack di team bus and officials afta dia exit.
Belmadi wey chop 47 years bin coach of di desert foxes for August 2018 wia im sign extension last year say im go remain for di post till 2026.
But a run of poor result mean say dis contract don dey terminated.
Belmadi captain Algeria for di 2004 Afcon wia as coach im carry di team win di title for 2019 wit 35-match unbeaten record.
But dem fail to qualify for di 2022 World Cup wia dia 2023 Afcon don end in disaster.
Tanzania suspend manager Adel Amrouche afta Caf eight-match ban

Wia dis foto come from, Getty images
Tanzania don suspend Amrouche afta Caf give am eight-match ban.
Caf also fine di Tanzania football federation $10,000 ova tins wey di coach don tok about Morocco.
Adel Amrouche tok say “Morocco get influence for Caf to manipulate match scheduling and officiating.”
One statement by di Tanzania football federation (TFF) tok say dem suspend dia coach for dis comment.
Interim coach Hemed Suleiman Ali don tok say “Amrouche still be our coach, dem no sack am. Dis na ban.”
Dis be di third time Tanzania dey play for di Afcon wia dem never reach di knockout stage.
Tanzania hire Amrouche for March 2023 wey im lead dem to di Afcon afta dem get draw wit Morocco for dia final qualifying match.
Di 55 year-old don coach Equatorial Guinea, Burundi, Kenya, Libya and Botswana.
Gambia coach Saintfiet resign

Wia dis foto come from, Getty Images
Gambia coach Tom Saintfiet don resign minutes afta di kontri crash out of di Afcon group stage without a point.
“Dis be my last match as Gambia coach despite say my contract don dey expire for August 2026,” Tom Saintfiet tok.
Di 50 year-old bifor di tournament don tok say im and di captain Omar Colley no go board one aircraft wey get oxygen wahala for air as dem dey go Ivory Coast.
Di aircraft return to Gambia afta dem find say oxygen no dey inside di plane during di journey.
Tom Saintfiet explain say “di team and staff get headache for di flight na so if di journey continue, we fit die.”
As dem finally arrive for Ivory Coast, dia performance no reach di level wia dem expect.
Di Gambia coach don chop criticism afta dem lose all three games to Cameroon, Guinea and Senegal.
Saintfiet lead Gambia to dia first Afcon for 2021 wia dem reach quarter finals.
Dis na Tom Saintfiet im 10th job for national team level.
Di Belgian tactician don coach Namibia, Zimbabwe, Ethiopia, Yemen, Malawi, Togo, Trinidad & Tobago and Malta bifor im join Gambia.
Ghana FA don sack Chris Hughton

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana football association don sack blackstars coach Chris Hughton wit immediate effect.
Dis na afta di poor performance by di team for di tournament.
Ghana don comot for group stage without winning a game, wia dem no win game for Afcon since 2021 for Cameroon.
For dat tournament also, di team don exit for group stage.
For Ivory Coast, di black stars lose to Cape Verde, wia dem draw 2-2 wit Egypt and Mozambique afta say dem concede late goals for all dia three matches.
Afta di elimination, di football association don release statement say dem sack di coach.
“Di executive council also don take decision to dissolve di technical team of di black stars”.
Di football association tok say dem go provide “roadmap for di future direction of di black stars.”
Dem don appoint Chris Hughton for di black stars job for February 2023, wia im win only four games out of thirteen games.
Di 65 year-old don coach Brighton & Hove Albion, Newcastle, Norwich City, Nottingham Forest and Tottenham bifor im become technical director for Ghana during coach Otto Addo im time.
Football sabi pipo say more coaches go chop sack by di end of di Afcon.
Ivory Coast coach resign

Wia dis foto come from, Getty Images
Jean Louis Gasset wey be coach of Ivory Coast also don resign.
Na im resign even bifor di team go know dia fate if dem fit qualify to di knockout stage as one of di four best third-place teams afta di group stage.
Ivory Coast get 3 points from three games.
Dem lose 0-1 to Nigeria wia Equatorial Guinea thrash dem 4-0.
Di Ivorian football federation appoint Jean-Louis in May 2022 afta Patrice Beaumelle fail to qualify di elephants to di world cup dat year.
For di Afcon for Cameron in 2021, dem also exit at di group stage.
Di 70 year-old Gasset also don dey face similar situation.
Emerse Fae go be interim coach for di elephants if dem manage to qualify to di knockout stage of di tournament.
Since im appointment, Jean-Louis supervise 13 matches (8W, 3D, 2L).
Di french man bifor di Ivory Coast job, don coach for oda teams like PSG, Montpellier, Saint Etienne and Bordeaux.













