Ivory Coast knock out defending champions Senegal afta penalty shootout

Ivory Coast players celebrate

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ivory Coast qualify for last 16 as best loser

Ivory Coast defeat defending champions Senegal 5-4 on penalties to eliminate dem from di Africa Cup of Nations afta di game end 1-1 during regulation time.

Franck Kessie decisive kick help di Elephants seal dia place for di quarter-finals afta Mousaa Niakhate bin miss im kick for Senegal.

Senegal bin take di lead afta only four minutes of di match through Habib Diallo volley from Mane cross.

Ivory Coast wey control much of di ball possession wait until di 86 minutes to find di equaliser from di penalty spot afta Mendy foul Pepe.

Di ref bin no give di penalty but VAR intervene, and Kessie cooly dispatch di kick to equalise in front of di home crowd.

Dis victory go taste sweet for di mouth of di Ivorians as dem bin only qualify for di last 16 as one of di four best losers. Plus dem even sack dia coach Jean Louis Gasset afta dia last group game wey dem lose 4-0 against Equatorial Guinea.

Senegal on di oda hand win all dia group games and start di match very well wit di early goal. But di Teranga Lions fail to go in search of di second goal as Ivory Coast begin to grow into di game.

Di substitutions wey di caretaker coach, Emerse Fae make na im swing di match in dia favour. Im send on Haller and Pepe wey later win di penalty wey help Ivory Coast equalise.

Both teams bin need extra-time to find di winner but dem cancel diasef as na penalty later decide di take.

Niakhate na im be di only player wey miss im kick as im shot hit di post. Kessie wey bin don score from di spot during regulation also convert di decisive kick to send di hosts and dia fans into wild celebration.

Wit dia victory, Ivory Coast go meet Cape Verde for di quarter-final of di 2023 Afcon.

Franck Kessie

Wia dis foto come from, Getty Images

Penalty shootout

Kessie to win am for Ivory Coast? Yes! Di midfielder fire im penalty beyond Mendy.

Mane score im penalty, 4-4. If Ivory Coast score di next one dem don win.

Aurier score im penalty, Mendy touch am but di ball still enta 3-4.

Dieng score e penalty despite say di keeper follow am, 3-3.

Haller score e penalty, 2-3.

Niakhate miss im penalty 2-2 now in favour of Ivory Coast.

Kouame score im penalty, 2-2.

Pape Sarr score Senegal second kick from di spot 2-1 Senegal.

Pepe score for Ivory Coast, Mendy follow di ball but e no catch am.

Koulibaly score di first penalty kickfor Senegal.

Second half extra-time

Full time afta extra-time: Senegal 1-1 Ivory Coast

Na penalty go decide who go win dis match and progress to di quarter-final.

120 mins - Nothing so far don fit separate two teams. Dem get two more minutes wey referee don add to find a winner.

117 mins - Dis two teams now don begin dey tink about penalties. Dieng don enter di game for Abdou Diallo.

115 mins - Ivory Coast make dia sixth substitution, Kossounou no fit kontinu so Wilfried Singo don replace am. Senegal dey ready Bamba Dieng to come on.

113 mins - Senegal pick di Ivory Coast defence like door lock as through pass find Mane wey dey free, e run towards goal before e cross for Ndiaye. Konan block di ball and deny Senegal a clear goalscoring chance.

109 mins - Ivory Coast pass di ball well between demsefs and to Adingra, di winger cross fly into Mandy arms and deny di hosts goalscoring opportunity.

106 mins - Play don resume and na now or never for one of dis two teams.

If nobody score afta 120 minutes dis match go enter penalty shootout.

First half extra-time

105+1 mins - Save! Good goalkeeping from Fofana, di goalkeeper rush out of im box to block Mane shot from going in.

Dat na di last chance of dis half as di ref don blow e whistle.

Still Senegal 1-1 Ivory Coast.

102 mins - From di corner Abdou Diallo try to do bicycle kick, e connect wit di ball but e dey too high. Somebody must find di winner today for dis match.

100 mins - Ivory Coast goalkeeper Fofana need treatment afta e hit di post wen e try to push clear a cross. Di ball go out for cornerkick.

97 mins - Aurier go close to scoring for Ivory Coast as im shoot from about 20-yards, di ball just skip past di post. Di Ivorian urge di fans to make noise aftawards.

95 mins - Serge Aurier don enter di ref notebook afta e foul Mane.

Meanwhile Iliman Ndiaye don replace Ismaila Sarr for Senegal.

93 mins - Simon Adingra pinch di ball from Koulibaly inside Senegal half, di Brighton forward quickly try to catch Mendy by surprise wit a shot but e no balance well as e shot no even go anywhere near di post to trouble Mendy.

91 mins - First half of extra-time don resume. Who among dis two teams fit find di winner?

Senegal 1-1 Ivory Coast.

Second half

Full time after 90 mins: Senegal 1-1 Ivory Coast

Dis game go go into extra-time

90+6 mins - Senegal get cornerkick but di cross go beyond everybody and out for goalkick.

90 mins - Seri bring down Mane, im receive yellow for di foul.

Meanwhile di ref don add seven more minutes.

If e end like dis di match go enter extra-time.

87 mins - Gana Gueye enter di match while Ivory Coast bin dey celebrate. E take di place of Camara.

86 mins - Goal for Ivory Coast! Kessie score from di penalty spot.

Senegal 1-1 Ivory Coast.

84 mins - Yellow card for goalkeeper Mendy.

82 mins - Ivory Coast feel dem suppose get penalty as Mendy rush out and clean out Pepe.

Di ref book Kouame for im protest as im ask for penalty.

Now VAR don ask di ref to go check im screee...PENALTY to Ivory Coast.

79 mins - Ivory Coast play dia last card wit dia final substitution. Christian Kouame ON, Seko Fofana OFF.

Senegal 1-0 Ivory Coast.

77 mins - Pepe to equalise? O what a good save by Medy. Di goalkeeper use im hands to punch Pepe left foot volley away from danger.

75 mins - Mane wit a shot inside di area...o no. Di forward no fit find di target as im shot from Sarr pass inside di box go narrowly wide.

Di ref don signal for cooling break.

73 mins - Kessie don get shot on target immediately e enter di game. Di midfielder rise high to meet Konan cross bit Mendy save di ball, from di rebound Adingra shot come off Haller wey bin dey offside position.

72 mins - Camara now don collect yellow card, di midfielder use im foot step on Pepe.

Ivory Coast don send on Kessie and Haller in place of Sangare and Krasso respectively.

70 mins - Lamine Camara shot from outside di box no dey on target, di ball go over di bar. Senegal don begin come out to play.

67 mins - Chelsea striker Nicolas Jackson don take di place of Habib Diallo di goalscorer.

66 mins - Senegal and Jakobs see anoda shot from di left go wide.

64 mins - Substitution for Ivory Coast, Simon Adingra and Nicolas Pepe don replace Diakite and Gradel.

62 mins - Despite say dem qualify as best loser, Ivory Coast don play well today but dem need to find a goal against dis solid Senegal defence.

59 mins - Diallo di goalscorer don collect yellow card as im use e hand foul Ndicka wen dem contest ball for air.

58 mins - VAR say no penalty. Senegal coach Aliou Cisse no dey happy wit di decision.

55 mins - Ismaila Sarr storm into di Ivory Coast penalty area come go down. Di ref say no penalty but wetin VAR go tok?

52 mins - Diakite dribble im marker race into di box but e cross no fit find e teammate as Mendy catch e cross.

47 mins - Mendy produce good save to deny Diallo from scoring Senegal second goal. Di striker receive di ball from Koulibaly quick freekick before e shoot low shot wey Mendy push out for corner.

Ivory Coast defence bin dey sleep wen Koulibaly play di freekick.

46 mins - Play don resume as di second half don start.

Ivory Coast need to find a goal else dem go suffer elimination.

Diallo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na Diallo second goal for dis Afcon

First half

Half-time: Senegal 1-0 Ivory Coast.

45+3 mins - Sangare lose di ball just outside im penalty area, di ball fall for Matar Sarr. Di Tottenham midfielder shot from outside di box no dey on target.

45 mins - Diallo nearly score Senegal second. Again na Mane create di chance as im cut di ball back from di left to Diallo wey trap di ball pass di keeper but e no fit turn well to score. Dat na good chance, Ivory Coast need to dey careful.

Di ref don add five more minutes before half-time.

40 mins - Mendy don dey forced into action afta e don enjoy some quiet start to dis match. Im spread imsef well to block Fofana attempt inside di box. Fomr di corner Koulibaly jump high to clear di ball.

38 mins - Ivory Coast work di ball well amongst demsefs, dem dey try to cut open Senegal. Di defending champions stand dia ground wella.

33 mins - Match don restart afta di break, still Senegal 1-0 Ivory Coast.

30 mins -Di ref, Pierre Ghislain don signal for cooling break. Time for both coaches to tell dia players sometin.

27 mins - Seko Fofana try to bamboozle im way into di Senegal box. Di Senegalese defenders no gree for am. Niakhate rush am quickly to block Fofana attempt.

20 mins - Ivory Coast don begin grow into dis game afta dia slow start. Dis time Kreppin Diatta bring down Gradel for foul. From di freekick, Gradel cross di ball straight into Edouard Mendy arms.

15 mins - Ivory Coast enjoy good period of possession, soon afta dem put pressure on Mendy to hurriedly clear back pass by Jakobs.

Sangare don re-enter di game, im dey okay.

13 mins - Dem don use stretcher carry Sangare comot for pitch. E no dey clear if e go still return to kontinu di game but play don restart.

9 mins - Yellow card for Sadio Mane as im bring down im opponent wit bad tackle.

Di challenge na bad one and e leave Sangare on di grass,im need treatment.

8 mins - Senegal just camp for Ivory Coast half dey totori dem. Di Elephants go need ginger demsef up if not dem fit concede again.

4 mins - Goal for Senegal. Mane dribble im way down di left before e cross di ball for Diallo. Di striker chest di ball down before e waya shot into di net.

Senegal 1-0 Ivory Coast

1 min - Senegal don begin dis match wit di first kick.

Straight from di start Senegal don dey on di offensive.

Dis one go hot well well. Senegal 0-0 Ivory Coast.

Senegal vs Ivory Coast lineup

Senegal XI: E. Mendy, Diatta, Koulibaly, Niakhate, Jakobs, A. Diallo, P. Sarr, Camara, I. Sarr, Mane, H. Diallo.

Ivory Coast XI: Y. Fofana, Aurier, Ndicka, Kossounou, Konan, Sangare, Seri, S. Fofana, Gradel, Diakite, Krasso.