How penalty help Cape Verde sama Mauritania 1-0 for round of 16

Wia dis foto come from, Getty Images
Cape Verde beat Mauritania 1-0 for di round of 16 tie to qualify for di last eight of di 2023 Africa Cup of nations (Afcon).
Di match wey happun for di Abidjan’s Félix Houphouët Boigny stadium on Monday 29 January, 2023 see di two teams try to outplay and outscore each oda.
Di two sides no fit score until di 89th minute wen Ryan Mendes score for Cape Verde thru penalty kick.
Pipo bin dey look Cape Verde as one of di ‘underdogs’ (small teams) but dem dey continue to shock evribodi.
Di Blue Sharks of Cape Verde dey in excellent form as dem bin finish ontop Group B wey get big names like Ghana, Egypt and Mozambique.
Cape Verde beat Ghana and Mozambique, and play draw wit Egypt, and afta dia match wit Mauritania dia unbeaten run still dey intact.
Match Highlights
Second Half
Cape Verde qualify for di Quarter-finals.
Full Time; caoe Verde 1-0 Mauritania
End of Di one wey oda users dey read well well
90+12 Referee blow whistle mtch don end
90+6' Aboubakary Koita of Mauritania comes close as im long-range free kick miss di right post.
90+6' Joao Paulo of Cape Verde commit foul. Mauritania get free kick.
90+5'Substitution for Cape Verde. Willy Semedo enta for t Steven Moreira.
90+4' Cape Verde take di corner, but dia hopes of scoring a goal end wit a nice clearance by di Mauritania defence.
90+3' Cape Verde dey enjoy di pressure at di moment, but one of di defenders clear di ball. Cape Verde get a corner.
90' Referee add 10 minutes
88' Cape Verde 1 - 0 Mauritania
GOAL! Ryan Mendes of Cape Verde puts di ball into di middle of di goal as e bet di outstretched arm of Babacar Niasse.
88' Ryan Mendes of Cape Verde take di penalty!
88' Babacar Niasse of Mauritania collect yellow card for infringement.
87' Penalty! for Cape Verde!
87' Babacar Niasse of Mauritania makes a slide tackle, but referee Mohamed Adel blows for a foul.
85' Substitution for Cape Verde. Jovane time don finish Benchimol replace am.
85' Aboubakar Kamara of Mauritania dribble plenti players and shoot from di edge of di box, but dem block im shot.
80' Kevin Lenini of Cape Verde get enough space inside di box to connect wit di corner. Im header flies towards di left post, but di goalkeeper dives to stop di ball.
79' Cape Verde get corner kick.
79' Substitution for Mauritania. Souleymane Anne don comot and El-Hadji Ba replace am. Ibrahima Keita play time don end and Cheick Elwely enta for am.
76' Dem kick Joao Paulo of Cape Verde off balance near di penalty spot and send im header from di corner wide off di right post. Di ball comot from di pitch and na goal kick for Mauritania.
73' Jamiro Monteiro of Cape Verde take di corner kick, e play am into di penalty area, but defenders clear am. Di ball go out of play and Mauritania get goal kick.
72' Double substitution for Cape Verde. Garry Rodrigues don enta for Bebe, Deroy Duarte don comot and Kenny Rocha Santos replace am.
71' El Hassan Houeibib of Mauritania don get minor injury, but im still dey able to continue.
70' Cape Verde corner kick no bring out anytin as defenders clear am.
69' Bebe of Cape Verde play di free kick dem get from distance, but di defensive wall bring di ball down. Di referee points to di corner flag in favour of Cape Verde.
66' Double substitution for Mauritania. Pape Ibnou Ba don replace Hemeya Tanjy while Sidi Bouna Amar don comot and Aboubakar Kamara replace am.
64' Cape Verde players dey exchange short short passes, dem dey try to buy time and calm di game down to beat di opposition defence.
59' Souleymane Anne of Mauritania receive good pass, im hammer di ball at goal from close range but im target go over di bar!
58' Cape Verde give Souleymane Anne of Mauritania plenti space, e attempt to score from long range, but di goal no dey threatened as di ball go wide of di left post.
57' Missed chance! Di free kick from di edge of di box wey Aboubakary Koita of Mauritania play no bring any result afta im direct shot just go wide off di right post.
56' Roberto Lopes of Cape Verde commit rough foul. Mohamed Adel stop di game and make a call. Mauritania get free kick from a dangerous position.
53' Deroy Duarte of Cape Verde strike anoda shot towards goal, but di goalkeeper no worry as defenders block am.
52' Jovane of Cape Verde fire one shot towards goal, but defenders block am.
51' Cape Verde no take advantage of di corner kick as Mauritania defender sweep di ball comot.
51'Cape Verde get corner kick.
50' Deroy Duarte of Cape Verde take one shot from di edge of di box, but e no disturb di goalkeeper as defender block im attempt.
48' Sidi Bouna Amar of Mauritania dey miss im luck afta im beautifully control one pass and from di edge of di box im fire shot on goal, but defender block am con clear di ball.
46' Jovane of Cape Verde send one pass sharp sharp into di box, but im attempt go throw-in afta defenders clear di ball.
46' Second half don start
First Half
45+3' First half don end.
45' Official show two minutes added time.
44' Joao Paulo of Cape Verde attempt a long crossfield pass, but di defence block di ball.
42' Sidi Bouna Amar of Mauritania hit one deep shot from di edge of di box twey dey off target. Di ball go out of play and Cape Verde get goal kick.
41'Mauritania work di corner short, dem pass di ball give one nearby teammate.
40' Hemeya Tanjy of Mauritania try to release Souleymane Anne wit thru ball, but dem stop im effort as Mauritania win corner kick.
40' Roberto Lopes of Cape Verde try to find one of im teammates wit one fine pass, but di defence reacts well to stop di effort.
36' Good play from Guessouma Fofana of Mauritania wey just enta, but im shot no dey accurate as e go wide off di left post. Di ball don comot from di pitch and na goal kick for Cape Verde.
35' Substitution! Omare Gassama of Mauritania don comot sake of injury, Guessouma Fofana don replace am.
35' Deroy Duarte of Cape Verde no succeed from im long-range effort afta im collect one pass den fire beta shot. Im attempt to surprise di goalkeeper no work.
31' Di ball dey out of play. Cape Verde get throw-in.
30' Referee Mohamed Adel stop di game. One of di players from Mauritania win di ball, but im effort no sweet di Ref.
29' Bebe of Cape Verde dey worry Mauritania o, e deliver one beta cross into di penalty area, but di opposition defender clear di danger.
27' Cape Verde get corner kick but defender Babacar Niasse of Mauritania block am.
26' Di ball from di corner kick land for Bebe of Cape Verde leg just outside di box, im fire di shot. Di strike go low towards di left post, but e deflect comot as Mauritania defenders block am.
26' Notin come out from di corner kick wey Cape Verde play, Mauritania defenders block am.
25' Bebe of Cape Verde try to cross di ball but Mauritania players clear am. Di ball don go out of play and di linesman say na corner to Cape Verde.
25' Cape Verde sdon dey get balance for di ball as dem hold ball possession. Dem dey wait for di right moment to create new attacking opportunities.
22' Bebe of Cape Verde shoot from di free kick spot towards di goal, but di ball fly go wide off di right post.
22' Referee Mohamed Adel blows im whistle for a foul afta Ibrahima Keita of Mauritania bring down one of im opponents. Cape Verde get free kick.
21'Aboubakary Koita of Mauritania attempts to slip di ball thru di defence, but im no find any of im teammates. Di ball goes out of play and Cape Verde get goal kick.
18' Cape Verde players dey play combine football as dem dey attempt to create opportunity to score goal.
15' Bodda Mouhsine of Mauritania shoot di ball from di mid-range free kick, but im effort go wide off di right post.
14' One of di Cape Verde players tackle im opponent and concede foul wey give free kick to Mauritania.
11' Kevin Lenini of Cape Verde don collect yellow card sake of one yeye tackle.
10' Ryan Mendes of Cape Verde bin dey close! Im collect pass for di edge of di box , im shoot am but di ball go inches wide off di right post. Di ball go out of play and Mauritania get goal kick.
8' Sidi Bouna Amar of Mauritania attempt to pick out im teammate wey dey free inside di box, but Vozinha comes off di line to clear di ball away.
7' See beta team play from Cape Verde as dem control di ball wit plenti short short passes. Dem dey try find space inbetween Mauritania defence to score.
4' Cape Verde no score from di corner as Babacar Niasse of Mauritania jump to collect di ball.
4' Steven Moreira of Cape Verde weave im way thru di opponents and strike di ball from di edge of di area, but Mauritania defender. block am. Cape Verde force dia opponents to concede corner kick.
1' Referee don blow whistle and di match don start
Line -Ups
Cape Verde starting 11: Josimar Dias, Roberto Lopes, Logan Costa, Jovane Cabral, Joao Fernandes, Jamilo Alvarenga, Deroy Duarte, Ryan Mendes, Thiago Correia, Steven Moreira, Kevin Pina
Mauritania starting 11: Niasse Barbacar, Diaw Khadim, Omare Gassama, Ba Lamine, Bodda Mouhsine, Hemeya Tanji, Anne Souleymane, AboubakaryKoita, Keita Ibrahima, El Hassen, Sidi Amar














