Why Ghana pipo vex about di poor Black Stars performance for Afcon 2023

Ghana

Wia dis foto come from, Getty Images

Reinildo Mandava last minute equaliser for Mozambique break Ghana hearts and deny dem automatic qualification for de knockout stages of 2023 Africa Cup of Nations despite say de Black Stars lead 2-0 afta 90 minutes.

Ghana bin comfortably dey in de lead thanks to two goals from de penalty spot by Jordan Ayew.

Wit only four minutes remaining before full-time, Ghana defenders go sleep.

First dem concede penalty wen de referee judge say Andre Ayew handle de ball inside de box. Geny Catamo convert de spotkick a minute into added time.

Den Reinildo Mandava rise high inside de box to head home de equaliser wey to make de game 2-2 and deny Ghana progress into de last 16.

Ghana now don fail to automatically qualify from de group stage of de last two Afcon but dem go only get demsefs to blame for de way dem finish dis game.

De draw see dem finish de group wit just two points after three matches, one point behind Egypt wey finish second wit three points afta dem also draw 2-2 wit Cape Verde.

Di island nation, Cape Verde top de group wit seven points while Mozambique sit bottom wit two points.

Dia hope of making de next round as one of de four best losers dey slim and dem go need results from oda matches to favour dem.

Wetin happun afta di game

Ghana football fans vex afta di latest result - Black stars no win game for Afcon afta six games.

Mohammed Kudus wey win man-of-di match don frustrate.

As dem present am di MOTM plaque, na im tok say “I dey short of words, I no fit explain wetin happun but we thank di fans for dia support.”

“We don give away two silly goals for four minutes. Dis be unacceptable.”

“Dis be big failure, big disappointment, I no fit explain am,” di West Ham star lament later for post-match press conference.

Afta di presser, na Kudus dey shed tears ova yet anoda terrible final ten minutes for match.

For di mixed zone, journalists don dey boil dey wait to fire di players and di coach for dia horror show for yet anoda tournament.

Handlers of di team wan ‘sneak’ di players for bus, but di angry journalists don give pressure until dem finally allow di players waka for mixed zone.

As dem dey waka dey go, some of di journalists don boo dem.

“You pipo be disgrace”, “Oh shame”, “Dis team na useless”, “We no go ask una any question, make you carry your shame go”, “Two Afcon, you no fit win simple game”.

Ghana fumble against Mozambique

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ghana fumble against Mozambique

Dejavu from AFCON 2021

Monday result don bring back memories from di 2021 Afcon for Cameroon for many fans.

For dat tournament, di black stars get only one point afta three games.

Ghana lose to Morocco wey dem draw against Gabon.

For di last group game vs Comoros, Ghana for just win and qualify for di knockout stage.

But for dat game, Ghana lose 2-3 to Comoros.

Dem score di winning goal for 85 minutes.

Na so plenti pipo tok say dis tournament na dejavu.

Di same poor game management and poor result for kontri wey win di tournament four times.

Wetin coach Chris Hughton tok

Di Ghana coach don dey under pressure throughout di group stage for di poor results.

For di three games, Chris Hughton im substitutions no help di team.

Afta di game Chris tok say “I don take responsibility for dis performance.”

“Since my time as coach, we no do well for dis competition.”

Many pipo don dey give pressure say make dem sack am.

Odas wan make im resign.

But di Irishman say im no dey tink about dat.

“I don frustrate about dis performance like any oda pesin but I no dey tink about sacking at dis moment”.

Caf disciplinary board fine Ghana for earlier fan disturbance

Even bifor di Ghana vs Mozambique match, Caf disciplinary board impose $15,000 fine for di Ghana football association ova fan disturbance during di Ghana vs Cape Verde match on 14 January.

How de match go down

Ghana fumble against Mozambique

Wia dis foto come from, Getty Images

Second half

FT: Mozambique 2-2 Ghana

Ghana don suffer elimination for group stage.

90+4 mins - Goal for Mozambique! Mandava rise high to nod de ball past de goalkeeper.

As tins stand Ghana dey go house.

Mozambique 2-2 Ghana

90 mins - Penalty for Mozambique! Chance now for Mozambique to score afta Andrew Ayew handle de ball inside de box. Catamo score!

Mozambique 1-2 Ghana

89 mins - Inaki Williams go play de final minutes of dis match as im take de place of Mohammed Kudus.

87 mins - Mozambique make dia final substitutions - Bonde and Nangy don enter di game in place of Guimaraes and King.

83 mins - Referee need to step in and separate de players afta foul on Kudus spark angry reactions from de West Ham midfielder. Jordan Ayew and Infren collect yellow cards in de process.

From de freekick Kudus shot go straight into de hands of de goalkeeper.

Mozambique 0-2 Ghana

80 mins - Ghana look comfortable on de ball now as dat second goal don give dem more belief.

75 mins - Close! Gido glamce e header from a cross onto de side net.

If Mozambique lose dis game dem go finish bottom of de group wit one point.

73 mins - For de oda group game, Egypt still dey draw 1-1 wit Cape Verde

Meanwhile Mozambique don send on Domingues and Ratifo to try get sometin out of dis match.

Dem substitute Amade and Nene.

72 mins - Ghana make two changes. Amartey and Alidu Seidu don replace Semenyo and Denis Odoi.

69 mins - Goal for Ghana! Jordan Ayew send de goalkeeper de wrong way to increase Ghana lead.

Mozambique 0-2 Ghana

67 mins - Penalty for Ghana! Referee Mutaz don point to de spot as Mandava use e hand block Kudus goal-bound shot. Chance for Ghana to increase dia lead as VAR don confam de penalty.

Two Mozambicans receive yellow for dia protests. Dem be Mexer de captain and Mandava de man wey concede de penalty.

64 mins - Ghana dey live dangerously as Mozambique don camp for dia half. E take defender Salisu left leg wey e use clear de ball to prevent Guimaraes cross from causing any danger.

62 mins - Now Alexander Djiku don collect yellow card. De defender pull back de shirt of Guimaraes. Djiku go also miss Ghana next match if dem qualify.

61 mins - Mozambique make dia first change. Witi don come off, Vilanculos don replace am.

58 mins - Yellow card for Baba Idrissu, de midfielder bring down Witi. Dat card mean say Idrissu go miss de next match if Ghana qualify.

54 mins - Catamo try to cross de ball into de box down de right, Mensah block e cross well as e go out for cornerkick. From de set piece, Ofori punch am clear and e rush back quickly to catch de rebound header from goin in.

50 mins - Chance for Mozambique! Ofori open im body well to save Amade shot.

Mozambique 0-1 Ghana

Meanwhile for de oda group game Egypt don equalise. As e stand Ghana go still go through in second place.

49 mins - Andre Ayew wey just come on don receive yellow card as im foul e opponent wit im hand.

48 mins - Mozambiqu don star de second half strongly. Richard Ofori punch clear dangerous cross into de area, from dat clearance Mozambique send de ball back in but Lau King fail to direct e header on target.

46 mins - Ghana don make anoda substitution. Andre Ayew don take di place of Joseph Paintsil

So de second half don start.

Jordan Ayew

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ayew penalty na e first goal for Afcon 2023

First Half

HT: Mozambique 0-1 Ghana

45+3 mins - Kudus try to produce di same type of goal e score against Egypt - a shot from outside de box - dis time e shot no dey on target.

45 mins - De first half of dis Group B match don almost come to an end. Referee Ibrahim Mutaz don add four more minutes.

Meanwhile Cape Verde dey lead Egypt 1-0.

As e stand Ghana go qualify automatically in second place.

41 mins - Mozambique don begin ask questions of de Ghana defence. Afta a period wia dem control possession Witi decide to try im luck from outside de box. Im shot no trouble Ofori at all as e rise like garri.

37 mins - Ashimeru no go fit kontinu for dis game as e be like e don pick up injury. Idrissu Baba don replace am.

34 mins - Mozambique cut Ghana open down di right but Bruno Langa cut back dey well defended by Abdul Samed.

Meanwhile Ashimeru don go down and need treatment.

31 mins - Now Geny Catamo don collect yellow card for poor tackle on Gideon Mensah.

Both teams don go for cooling break.

28 mins - Majeed Ashimeru don become de first player to receive yellow card for dis game as im bring down Amade.

Still Mozambique 0-1 Ghana

25 mins - Guimaraes produce good skill to go past im marker before e knack through pass for Lau King but e overhit de ball as goalkeepe Ofori race out of im goal to catch de ball.

24 mins - As tins stand, Ghana get four points and dem go finish second behind Cape Verde wey get seven points. Egypt dey on three and Mozambique get only one point. But time still plenty before de 90 mins for tins to change.

22 mins - Jordan Ayew send in dangerous cross into de box. De ball dey too high for Paintsil to meet am as e go out for goalkick.

Meanwhile Egypt and Cape Verde still dey play goalless for de oda group match.

18 mins - Dat goal go calm tins down for de Black Stars wey don start de game well.

15 mins - Goal for Ghana! Jordan Ayew cool finish send Ghana into de lead.

Mozambique 0-1 Ghana

13 mins - Penalty to Ghana! Joseph Paintsil dribble past im marker Infren before di defender bring am down. Chance now for Ghana to take de lead. Na Jordan Ayew wan take am.

8 mins - De Black Stars look like dem go threaten Mozambique from di wings.

Jordan Ayew send in a cross into de danger area, de ball cause small panic for dia opponents but e no find anybody inside de box.

5 mins - Ghana look sharp not only in dia white jersey but in possession too.

Odoi don dey penalised for fouling im opponent. Di right back look very gingered in di early opening of dis game.

1 min - Mozambique take di opening kick to start di match and straight from dia dem lose di ball to Ghana. Semenyo try im luck from outside di box, di goalkeeper save am wit im finger tips go out for cornerkick.

Wow, what a start to di match!

Mozambique 0-0 Ghana

Ghana vs Mozambique line-up

Ghana XI: Ofori; Odoi, Djiku, Salisu, Mensah; Abdul Samed, Ashimeru; Paintsil, Kudus, J. Ayew; Semenyo

Mozambique XI: Ivan; Nanani, Mandava, Mexer, Bruno Langa; Amade, Nene; Witi, Guimaraes, Catamo, Lau King

Fans para ova di Ghana loss

For fans wey watch di game for stadium, dis be di lowest for di black stars.

“How we fit give away dis game at 2-0 on 90 mins? Di team no try,” one fan tok as im dey cry.

“Ibi time say make dem sack di coach, im no fit do di job,” anoda pesin tok.

For one ogbonge sports journalist, Saddick Adams, dis na heartbreak.

“Dis for cause mass resignations now”.

Anoda pesin Owuraku Ampofo tok say “time don come say make some of di players leave di black stars, one of dem na goalkeeper Richard Ofori.”

“Im for pack im bags den leave”.

Many odas sabi say make goment dissolve di Ghana football association and di entire team.