Tension, personal issues and plenty drama - wetin go happun for Biden, Trump debate

Wen Donald Trump and Joe Biden go take to di debate stage on Thursday night, e go be like reunion but dis no go be a friendly one.
No current president don ever debate im predecessor bifor and di rivalry wey dey between dis two go dey obvious for di debate.
Trump neva gree say President Biden win di 2020 election. Days afta di election, Trump supporters attack di US capitol and im no attend di inauguration of Biden.
Di two men dey face diasef again for di presidency and dis debate go mark di first time for dis election campaign wey millions of Americans go sidon and pay attention.
Di stakes dey high and di tension for di room go dey very high as both candidates go try to convince US voters say dem deserve dia vote in November 2024.
Biden vs Trump: Wetin don happun bifor
Thursday night debate go also mark di first time wey Joe Biden and Donald Trump don appear togeda since dia debates wey happun four years ago.
Dia first encounter for 2020 na very high tension show.
Oga Biden dey frustrated and repeatedly say “Will you shut up, man?”
End of Di one wey oda users dey read well well
At di start of di second debate dat year, Trump Covid diagnosis bin delay small and di two men no even shake hands.
None of di two candidates don participate for any kind of debate in nearly four years. Even Trump skip di Republican primary debates wen im be nominee earlier dis year.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wen be di debate and how e go take waka?
Unlike past debates, dis one go dey conducted for one cable television studio without live audience wey go cheer or cry.
Di na request by di Biden campaign, wey dey reportedly concerned afta Trump bin hold one town hall forum hosted by CNN last year and e get some katakata.
Di debate go also feature muted microphones for candidates during wen dia opponent dey speak. Dis go prevent di debate from turning into gbas gbos between di two candidates like wetin happun during di first Trump-Biden debate for 2020.
Di debate go happun on Thursday 27 June 2024.
Na for CNN debate stage in Atlanta di face-off go happun.
Who old pass-Biden or Trump
For Joe Biden and Donald Trump - dis two oldest candidates eva to contest for di US presidency - age na one of election issue wey dem no fit escape.
On Thursday, di current Democratic president Biden wit 81-year-old, and im Republican predecessor Trump wit 78-year-old go rty out dia physical and mental strength.
For 90 minutes, under di view of high-definition cameras, President Biden and former President Trump go tok on issues wey concern di economy and foreign wars to immigration and di future of democracy.
If anyone of dem slip, stumble or even fall, e go raise concern about dia age and voters go begin dey pay attention for di tight presidential race.
But a good performance by Biden who be di nation oldest president go clear questions about im stamina and mental fitness since e take-ova office.













