Nikki Haley announcement clear road for Trump, Biden US presidential election battle

Wia dis foto come from, Getty Images
Di last Republican contestant wey dey drag di Presidential candidate ticket wit Donald Trump, Nikki Haley don suspend her presidential campaign.
Dis suspension mean say na only Donald Trump remain for di Republican party wey wan contest for Presidency.
Nikki Haley don announce say she go suspend her campaign - but she tok say she “no regret".
"Just ova one year ago I launch my campaign for president, wen I start, I tok say di campaign na ground for my love in di kontri,” she tok during her open speech on Wednesday.
"Na last week, my mama, first generation immigrant, vote for her daughter for president. Only for America."
Dis dey come afta President Joe Biden and Trump sweep di state primaries wey happun on Tuesday.
Afta di results from dis ogbonge presidential primaries wey dem tag 'Super Tuesday' e clear say anoda competition for who go enta di White House go start between President Joe Biden and Donald Trump.
How di results for Super Tuesday go?
For di Super Tuesday results, Presiden Joe Biden win di Democratic nominating contests for 14 states - plus Iowa, wia pipo vote by post - but im lose for di American Samoa territory by 11 votes.
End of Di one wey oda users dey read well well
Meanwhile, former President Donald Trump win 14 Republican contests - e cement im strong overall lead over Haley, even though she win for Vermont wey surprise pipo.
Biden and Trump dey look forward to wen dem go face each oda again as dem begin insult each oda afta dem confam say na dem win.
Trump tok say di US no get kontri if im opponent win di election, while Biden accuse Trump say na "vex dey push am" no be say im get di good of Americans for mind.
Dem dey give candidates wey win delegates - dem need a particular number to get official nod from dia parties to contest for president.
Immigration and di economy na di important issues for Republican voters wen dem ask questions for di CBS exit polls for Virginia and North Carolina.
Highlights of Super Tuesday
Trump get beta performance, wit some ogbonge victories - wey be 70% margin in Alabama, 61% for Texas, around 70% of di vote for California
Exit polls show strong backing among voters sake of Trump position on immigration - one topic wey dey for fronyt of Trump political agenda since 2015
Haley surprise win for Vermont fit happun sake of di campaign wey bring anti-Trump voters from all factions togeda.
Back wey President Biden get dey shake sake of di Gaza protest vote for Michigan last week, and e happun again for states like Minnesota and North Carolina - wia some significant percentage of voters registered as 'uncommitted' or 'no preference' (dem no get any choice)
Meanwhile US media dey report say, Haley no dey plan to support Trump during her speech wen she go confam her withdrawal.
US tori pipo add say she dey plan to tell di former president to convince her Republican and independent voters to support am for di November general election.
Dem say na big task for Trump, as im need di kind of local, moderate, college-educated voters wey dey for Haley group if im want win back di presidency.
President Joe Biden dey also waka near wia dem go select am again, di two major-party candidates fit face each oda well now, for wetin go shape up di longest general election campaigns for US history.
Two of dem don already paint a dark picture of wetin dey ahead store if dia opponents win.
Trump fit contest di US election?

Wia dis foto come from, Reuters
Di US Supreme say Donald Trump fit contest di Presidential election.
Di Courttok afta dem strike down all di efforts wey individual states dey make to disqualify Donald Trump wit one constitutional clause wey dey against pipo wey bin cause or try to cause kasala for di kontri.
For dia unanimous ruling wey dey specific to Colorado, e also cancel di challenges wey oda states bring.
Colorado bin bar Mr Trump from im Republican primary, s dem bin argue say na im ginger di 2021 Capitol riot.
Di court rule say only Congress, get di power, no be states.
Di Supreme court ruling clear road for Mr Trump to compete for di Colorado primary wey happun on Tuesday.














