'My memory dey fine' - America President Joe Biden vex tell special counsel wey probe am
US President Joe Biden vex criticise one investigation wey find out say im mishandle top secret files and say im dey struggle to remember key life events.
For surprise news briefing on Thursday evening, Oga Biden insist say: "My memory dey fine."
Im condemn one claim wey say im no fit remember wen im son die, e tok say: "How di hell im go raise dat kain tin?"
Di inquiry find out say Oga Biden "knowingly retain and disclose" classified files, but decide not to charge am.
Department of Justice Special Counsel Robert Hur na im decide say Oga Biden bin keep classified documents related to military and foreign policy in Afghanistan well afta im serve as vice-president.
Di 345-page report, wey dem release earlier in di day, say di president memory get "significant limitations".
Oga Hur bin interview di 81-year-old president for ova five hours as part of di inquiry.
Di special counsel, na one Republican wey dey appointed for di role by Biden attorney General Merrick Garland, e say Oga Biden fit no recall wen im be vice-president (from 2009-2017), or "even within several years, wen im son Beau die" for (2015).
End of Di one wey oda users dey read well well
For Thursday night news conference, Oga Biden bin dey emotional im lash out at di passages wey bin dey cast doubt for im recollection of events.
"Frankly, wen dem ask di question I tink am say, na none of dia damn business," e tok.
"I no need anyone to remind me wen he [Beau Biden] die."

Wia dis foto come from, Getty Images
Im say im bin dey "very occupied... sake of say im bin dey handle international crisis" wen di special counsel bin interview am from 8-9 October last year - just as di Israel-Gaza war start.
Di inquiry also say Oga Biden bin share some of di sensitive material from hand-written notebooks wit one ghostwriter for im memoir, finding wey di president deny from podium.
Di special counsel conclude say e go dey difficult to convict di president of improper handling of files because "for trial, Oga Biden go likely present imself to jury, as im do during our interview wit am, as sympathetic, well-meaning, elderly man wey get poor memory".
Opinion polls indicate say di president age na concern for US voters ahead of November White House election. But Oga Biden tell reporters on Thursday say im be di most qualified candidate.
"I mean- well," e tok. "And I be elderly pesin. I know wetin I dey do. I go put dis kontri back on im feet.
"I no need im recommendation."
However, even as im try to shoot down reporters questions about im age and mental sharpness, im mistakenly refer to Egyptian leader Abdul Fattah al-Sisi as di "president of Mexico".
Dem ask am to comment on di latest for di Israel-Gaza war, im say: "I think as you know initially, di President of Mexico, Sisi, bin no wan open di gate to allow humanitarian material to enta."

Wia dis foto come from, DOJ
Dem ask am weda im go take responsibility for di classified documents wey dey im house, Oga Biden blame im staff.
Im say im no know say dem put sensitive memos for im garage, wia di special counsel say dem see am next to one dog bed.
One BBC reporter for White House Diplomatic Reception Room describe di atmosphere as tense.
Wen one journalist say di American pipo dey concerned about im age, Oga Biden raise im voice reply dem: "Dat na your judgement, dat na your judgement."
Im insist say im memory dey "fine" and add say "e neva worse" during im presidency.
Oga Biden legal team also criticise di special counsel remarks about Oga Biden memory lapses.
"Di report use one kain language to describe commonplace occurrence among di witnesses dem: lack of remembering old events wey happun years ago," na wetin one White House lawyer Richard Sauber write for one letter wey bin dey attached to di report.
Di top secret files wey dem find for Oga Biden house for Wilmington, Delaware, and former private office na from 2022-23.
Di discovery dey come afta one separate investigation bin charge former President Donald Trump, 77, wit mishandling classified documents afta im leave di White House. Im dey face trial for dat case dis May.
Di Hur report distinguish between both cases, say Oga Biden bin hand ova di documents to goment archivists, while Oga Trump "allegedly do di opposite".

Wia dis foto come from, DOJ
"According to di indictment, im no only refuse to return di documents for many months, but im also stop justice by involving odas to destroy evidence and den to lie about am," di report tok about Oga Trump.
Oga Trump, for im response, say im make di justice department prosecutor cancel im classified files trial.
"If Special Counsel Jack Smith wan do good for our kontri, and help to unify am, make im drop all litigation against Joe Biden Political Opponent, ME, and let our Kontri HEAL," di Republican White House frontrunner post for im platform, Truth Social.
Additional reporting by Rebecca Hartmann















