Wetin dey inside di health deal Kenya sign wit America

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Wycliffe Muia
- Reporting from, Nairobi
- Read am in 4 mins
Kenya don sign one historic five-year health agreement wit di US.
Dis na di first of such contract since Donald Trump administration end foreign aid programme to di kontri.
Di aim of di $2.5bn (£1.9bn) deal na to fight infectious diseases for Kenya, wit similar agreements wey dey expected to roll out for oda African kontris wey dey in-line wit Trump wide foreign policy goals.
Di govment-to-govment deal aim to boost transparency and accountability but e dey raise fears say if e fit give US real-time access to critical health database, including sensitive patient information.
Kenya Health Minister Aden Duale don push dia fear go corner as e tok say na "only de-identified, aggregated data" dem go share.
For im first day in office for January, Trump bin announce say im go freeze all foreign aid as part of one new govment spending review.
E dismantle di US Agency for International Development (USAID) and cut billions of aid wey dey go veri poor kontris.
Dis lead to sharp reduction and availability of some drugs for developing kontris.
For September, di Trump administration bin introduce one "America First Global Health Strategy", wey make aid to dey dependent on negotiations wey officials bin tok say go cut waste and advance US priorities.
Wetin dey inside dis new deal
Under di deal wit Kenya, di US go contribute $1.7bn, and di Kenyan govment go cover $850m and dem go gradually take up more responsibility.
Di deal dey target di prevention and treatment of HIV/Aids, malaria, and tuberculosis, maternal care, polio eradication and infectious disease outbreak response and preparedness.
During di signing of di agreement wit Kenya President William Ruto, US Secretary of State Marco Rubio describe am as "landmark agreement," and e refer to Kenya as "longstanding American ally".
E praise Kenya for dia role to lead and contribute to di UN-backed mission wey dey work to combat powerful gangs for Haiti.
"If we get five or 10 kontris wey dey willing to step forward and do just half of wetin Kenya don do already, e for be extraordinary achievement, "Rubio tok.
Di secretary of state explain say di US bin want dia foreign aid to go directly to govments, instead of aid agencies and charities.
"We no go spend billions of dollars to funding di NGO industrial complex while close and important partners like Kenya either get no role to play or get veri little influence over how dem dey spend health care money," im tok.
Kenya president say dem go use di money to work towards priorities for di kontri, like to buy modern equipment for hospitals and to boost dia health workforce.
"I assure you say we go spend evri shilling and evri dollar well, effectively, and accountably," Ruto add.
However, some Kenyans dey demand make Ruto tell dem di full agreement, wit fear say e fit allow di US to view personal medical records like HIV status, TB treatment history, and vaccination data of Kenyan patients.
"Which specific data categories we dey share? Na genomic data, disease patterns, mental health data, insurance claims, hospital records, or biometrics included? If not, why dem no write am openly?" lawyer Willis Otieno post on X.
Well-known whistle-blower Nelson Amenya bin voice similar concerns, wen e beg di Kenyan govment to release di full agreement so "we fit read am by oursef".
Minister Duale bin don dismiss such fears, e insist say Kenya health data go remain secure and fully protected by Kenyan laws.
"Your health data na national strategic asset," Duale added.
US officials neva comment on di data concerns yet.
A number of oda African kontris dey expected to sign similar agreements by di end of di year, according to US officials.









