Late OAU zookeeper die as e dey try save im colleague from di Lion - Authorities confam

Wia dis foto come from, Getty Images/OAU
Authorities of Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Osun state don describe di Olabode Olawuyi, di zookeeper wey die as lion attack am as brave man.
Di University say e die as e dey try to rescue one female colleague wey di lion attack.
Tok-tok pesin for di institution, Abiodun Olanrewaju, tell BBC say di incident happun on Monday, 19 February 2024 wen di unnamed female colleague dey feed di nine-year-old lion.
Olanrewaju explain say dem no properly lock one of di doors to the lion den wey make di animal fit escape and attack di female zookeeper. Olawuyi immediately enta di lion den to rescue di woman, but di lion attack am also.
Oda members of staff wey bin dey di scene of di incident do everything within dia power to rescue am but di lion don already injure Oga Olabode well-well, wey lead to im death.
“Di incident dey heartbreaking for all di staff and students of di University,” Olanrewaju tok.
Di school don seal off di zoological garden of di institution.
Oga Olabode wey be Veterinary Technologist bin dey in charge of di Zoological garden for more dan 10 years. E also be di keeper of di nine-year-old lion.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di tok-tok pesin add say di institution dey wait for di family of Olawuyi to pick di burial date.
BBC bin also visit di family house of di deceased for Ile Ife but dem no wan tok as dem still dey in shock.
One oga Olabode Olawuyi wey be di veterinary technologist in charge of di Zoological Garden of di Obafemi Awolowo University, Ile-Ife Osun State South west Nigeria don die.
Na one nine year-old lion kill di man inside campus wen e dey try feed am, di management of di school tok.
Abiodun Olanrewaju, tok-tok pesin for OAU for statement wey e release on Monday bin dey inside garden dey feed di animals wen di incident happun.
Olanrewaju say some members of staff wey dey dia try to rescue di veterinary technologist but di lion don wound am well-well.
“The management, staff, students and the entire campus of di Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Osun State, dey mourn sake of di untimely death of oga Olabode Olawuyi,” di statement tok.
Tori be say na oga Olabode breed di lion since e small – e don breed am for nine years.
Afta di incident happun wey di lion wound di veterinary technologist, hunters begin dey try kill am.
Di cage wey di lion dey stay na very open place wey e go fit dey waka round and many pipo dey fear di lion well well.
Wen di hunters go di cage, dey shoot di lion for leg. One bullet wey touch am, di lion try to run but di bullet don already meet am for leg.
Plenti hunter bin stand outside wit dia guns incase di lion wan revenge or run comot.
As di lion try to run, di bullet wey touch am don break im leg - naso e fall for ground.
Wia di lion dey stay also confam, according to video say e dey restricted to go out. E mean say di pesin wey dey feed am go gatz enta di cage to go feed am and to escape during attack go don dey difficult for di deceased.
According to di Vice Chancellor, di deceased dey breed di lions for many years but dem no know wetin come on di male lion why e go attack am.
Dem rush oga Olabode go medical center but di mata don pass treatment as life don comot im body.
"Di staff bin try to rescue am but di grip of di lion too much. So dey gatz call on di security. By di time dem go fit rescue Bode, im don sustain plenty fatalities."
"Na pity say we loss one of our staff for di line of duty and di university don send delegate go di wife house."
Dis no be di first time wey late Olabode go dey train and breed lions but how dis one come grow to attack am na di surprising part for pipo.













