Diddy call witnesses from prison, goment lawyer tok

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Mark Savage
- Role, Music Correspondent
- Read am in 6 mins
Sean "Diddy" Combs don break prison rules by contacting potential witnesses for im upcoming sex trafficking trial, goment lawyers allege.
Di music billionaire chop accuse of making "relentless efforts" to "corruptly influence witness testimony", by using oda prisoners telephone accounts, and using three-way calls to tok to pipo wey no dey im approved contacts list.
Goment lawyers say review wey dem make of recorded calls also show say Oga Combs give im family instruction to contact potential witnesses for im case, dem tok for one court filing.
Combs wey be 55 years, currently dey inside custody for Manhattan. Im don plead not guilty to all di accuse against am, and seriously deny say im do anytin wrong.
Court deny Diddy wey dem sabi wella for 1990s ogbonge songs like I'll Be Missing You and Mo' Money, Mo' Problems, bail since dem arrest am, as different different judges say e dey risky as im fit tamper wit witnesses.
Im lawyers bin still try get bail for am last week, proposing $50m (£39.6m) package plus security guards wey go monitor am 2/4/7 as im dey under house arrest.
Lawyer Alexandra Shapiro argue say e dey impossible for di musician to prepare for trial from prison sake of di "extremely plenty" amount of material wey im gatz review, especially witout laptop computer.
She also say im condition for di prison, including frequent lockdowns and officers collecting im pen wey im dey use take note, no let am prepare well.
Detention no dey allow Oga Combs get "any real opportunity" to get ready for trial, violating im rights under di US Constitution, Shapiro say.
In response, di goment lawyers argue say make dem deny im request, unto allegation say Combs "na serious risks of danger and blockade of dis trial".

Wia dis foto come from, Reuters /Jane Rosenberg
For court documents, dem accuse di star of writing social media posts try "influenced kain pipo wey fit sit for di jury" for im trial.
Some of di effort according to dem, na one Instagram statement wey one woman wey dem sabi only as "witness two" post, countering allegations wey singer Dawn Richard make for one civil case against Combs.
Goment lawyers alledge say she and Combs bin draft her statement during "multiple texts" and "multiple calls" from prison.
Dem also allege say e get "strong assumption" say Oga Diddy "pay witness two, afta she post her statement".
Dem also say one video wey one of di star seven children bin post on 5 November na evidence of "public relations strategy to influence dis case".
Di video, wey many tori pipo bin report, show di family as dey dey wish Combs happy birthday during one prison phone call.
"Di defendant den monitor di analytics – dat na audience engagement - and openly discuss wit im family how to make sure say di video get di kain effect wey im bin desire on potential jury members for dis case," prosecutors tok.

Wia dis foto come from, Diddy / Instagram
Combs bin also chop accuse of using di phone account of at least eight oda prisoner to make calls, wey dey against prison rules; and of "directing odas" to arrange payment for dis access.
Goment lawyers say Combs dey run "relentless" schemes to "contact potential witnesses, including victims of im abuse wey fit to provide powerful testimony against am".
'Strange ability'
Begging di judge to deny Oga Combs request for bail, di goment lawyer write say "no set of conditions" fit eliminate di potential risks to di trial.
"Di defendat don show very strange ability to get odas to do wetin im want - employees, family members, and prisoner too," dem claim.
"E no get any reason to believe say private security guards sef no go fall in line."
Prosecutors also reject criticism of di conditions for di Metropolitan Detention Centre for Brooklyn, citing one interview from di star lawyer Marc Agnifilo, wey tok say "food na probably di roughest part" of Combs adjustment to life behind bars.
Di musician lawyers never still react to di court motion.
BBC don contact im legal team for response.

Wia dis foto come from, EPA
Combs legal palava begin last November, wen im ex-partner Cassandra "Cassie" Ventura fill civil lawsuit, alleging incidents of rape and physical assault between 2007 and 2018.
Although dem sharply settle di case out of court, e lead to plenty more similar accuse plus one investigation by US Goment.
Federal agents raid Diddy properties for March, and dem arrest am for New York for September.
Combs dey face charge of three counts of sex trafficking and racketeering, for one federal indictment we describe allegations of drug-fuelled, days-long sexual performances wey dem call am "Freak Offs".
Di musician at di same time dey face more dan 24 civil cases by men and women wey dey accuse am of sexual assault, rape and sexual exploitation.
Di star don seriouslt deny all di charge against am and claim for di civil cases say di sexual encounters wey be di koko of im criminal case, all na wit consent.
New case file against lawyer
For one separate development on Monday, someone file new case against one of di lawyers wey dem sabi wella for leading more dan 120 lawsuits against Combs.
Di new case, wey one "high-profile pesin" wey dem no give im name file against Texas attorney Tony Buzbee, allege say Buzbee attempt to force am by threatening to make public one “entirely fabricated and malicious allegations of sexual assault".
For di court documents wey BBC see, di plaintiff identify imsef as one of Diddy former associate and agree say im bin attend some events wit di music mogul.
Di case against Buzbee claim say di Houston attorney dey follow one "clear playbook" for forcing celebrities by fabricating allegations and demanding letters asking for payment.
Di case allege say if dem no meet di demands, di lawyer go enta media to apply public pressure.
Buzbee wey deny say im no do anytin wrong, describe di case as “last-ditch attempt” to stop am from naming di individual.
“E dey obvious say di yeye case wey dey file against mt company na aggressive attempt to intimidate or silence me and ultimately my clients,” im tok for one statement wey in send to BBC.
"No amount of money dey included for di demand letters," im write. "Dem no make any threats. Di demand letter wey dem send no get any difference from di ones wey lawyers across di kontri dey usually send for all types of cases.”
Additional reporting by Samantha Granville









