South Africa representative Mia Le Roux withdraw from Miss Universe competition just before di grand finale

Mia Le Roux

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

South Africa representative for dis year Miss Universe pageant Mia Le Roux don withdraw from di competition days before di grand finale.

Inside statement for di social media page of Miss Universe South Africa, dem say she pull out because of health concerns.

"Na with deep regret we share di news say Mia Le Roux, Miss South Africa 2024 don get to withdraw from di Miss Universe competition due to health concerns." Di statement tok in part.

Di statement bin come on di night when di preliminaries of di Miss Universe competition bin happen and fans bin dey expect di South African representative to walk di stage.

Di grand finale of di pageant na on 16 November.

For di same statement, Mia say "I dey very thankful for di strong support from South Africa during my time for Miss Universe. Making dis decision bin dey very challenging knowing di dreams and hopes wey bin dey placed upon me. However, I dey deeply grateful to get di opportunity to focus on my health and recovery so I fit continue to serve my country with my full strength." She tok.

E mean say South Africa go no longer get representative for dis year event.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Mia le Roux become di first deaf woman to dey crowned Miss South Africa after a divisive competition wey bin see one finalist withdraw after dem troll her over her Nigerian heritage.

23-year-old law student Chidimma Adetshina bin pull out of di competition following allegations say her mother may bin steal di identity of a South African woman.

Adetshina go on to accept an invitation from Miss Universe Nigeria to partake for dia competition, she win am and dey represent Nigeria for di Miss Universe 2024.

Meawnhile for her acceptance speech, Ms Le Roux bin say she hope her victory go help those wey feel excluded from society to achieve dia "wildest dreams, just like she dey do".

She say she bin wan help those wey dey "financially excluded or differently abled".

Ms Le Roux, 28, bin dey diagnosed with serious hearing loss at di age of one and get cochlear implant to help her recognise sound.

She say e take her two years of speech therapy before she dey able to say her first words.

After winning, di model and marketing manager say: "I be a proudly South African deaf woman and I know wetin e feel like to dey excluded.

"I know now say dem put me on dis planet to break boundaries and I do am tonight."