Miss Universe 2024: When e be, how to watch and oda tins you need to know

Miss Universe candidates from South Africa, Nigeria and USA

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di Miss Universe 2024 go be di 73rd Miss Universe pageant and e go hold for Arena CDMX for Mexico City, Mexico on Saturday16 November, 2024 and Sunday 17 November by 3:00am for Nigeria.

Reigning Miss Universe, Sheynnis Palacios of Nicaragua go crown di next Miss Universe from di 130 contestants wey dey compete for di crown including Chidimma Adetshina of Nigeria.

Dis tori break down everything you need to know about di pageant dis year.

When be Miss Universe 2024?

Di 73rd Miss Universe pageant go happen for Arena CDMX inside Mexico City, Mexico on Saturday16 November, 2024 and for early morning on Sunday 17 for Nigeria.

Di activities for di pageant bin first begin on Monday, November 11. Di opening competition wey dem dey call di Preliminaries and di National Costume Show happun on Thursday, November 14.

Di National Costume Show na wia di girls dey showcase reference di kontris wey dem come from.

Where to watch Miss Universe 2024

Dis year Miss Universe go dey live on Telemundo YouTube channel.

You also fit follow for di Miss Universe platforms like YouTube.

How dem go crown di winner ?

Contestants for di 73rd Miss Universe don already begin land for Mexico since ending of October and dem don dem don dey attend several functions since 1 November like galas, coctails and go on toura and excursions.

But Preliminaries and National Costume Show go happen on 14 November.

Voting of di candidate into di top selected candidates for di Semifinals to advance into di Finals, and Best Costume competition go also dey opened to fans among other potential voting scenarios.

On November 16, 30 selected candidates go parade inside a swimsuit round, where 18 of dem go leave di competition.

Di 12 wey continue (semi-finalists) go parade in evening dress wia anoda seven go dey eliminated from di contest.

Di remaining five finalists go undergo a final question from di jury, wey go determine di final positions and di winner.

'Yes to inclusiveness'

Chidinma Adetshina
Wetin we call dis foto, Chidimma Adetshina of Nigeria dey among di 127 contestants

South Africa Miss Universe representative, Mia le Roux, bin make history as di first-ever contestant with hearing impairment to compete for di prestigious title. Di 28-year-old beauty queen bin join over120 oda contestants for di 73rd Miss Universe Pageant before she withdraw due to health concerns on Friday.

Chidimma Vanessa Onwe Adetshina dey represent Nigeria after a unique journey. Initially she enter di Miss South Africa pageant, but withdraw due to one citizenship palava.

After winning Miss Universe Nigeria, Chidimma hope to make a significant impact, as Nigeria don only contest twice in di history of di competition.

Miss Universe Egypt Logina Salah dey also make her mark as a pesin with vitiligo to contest for di beauty pageant. She also be vitiligo advocate to raise awareness about di condition.

Miss Universe Somalia Khadija Omar go be di first hijabi woman to represent Somalia at Miss Universe. Born in di Hagadera refugee camp in Kenya, Khadija emigrate to Canada in 2010 and now dey use her platform as a beauty influencer to advocate for inclusivity.

Filipinos dey throw dia support for Chelsea Manalo, di country first Filipino-Black American representative, to take home di Philippines fifth Miss Universe crown.

Dem go also ginger for three oda half-Filipino contestants wey be New Zealand Victoria Velasquez Vincent, di United Kingdom Christina dela Cruz Chalk, and Bahrain Shereen Ahmed.

Miss Universe 2023 Crown

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Miss Universe 2023 Crown

Which African countries dey contest?

Contestants from Africa for Miss Universe 2024 include Angola, Botswana, Cameroon, Democratic Republic of Congo, Cote'd Ivoire, Equatorial Guinea, Egypt, Eritrea, Guinea, Kenya and Mauritius.

Odas include Namibia, Nigeria, Senegal, Somalia, Tanzania, Zambia and Zimbabwe.

Since Zozibini Tunzi of South Africa make history to be di first black woman with natural afro-textured hair to win di pageant for 2019, expectation dey strong to see anoda African contestant take di crown. But dis one dey possible? Saturday go tell.