Wetin Nigeria fit benefit from G20 summit wey President Tinubu dey attend

Nigeria President Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu

Read am in 4 mins

Nigeria President Bola Tinubu don arrive for Rio de Janeiro, Brazil, to attend di 19th Heads of State and Government Summit of di Group of 20 (G20).

Na Ambassador Breno Costa for di Ministry of External Relations of Brazil receive President Tinubu wey arrive on Sunday at 11.03 p.m. local time, (Monday 3. 03 a.m. Nigerian time).

President Tinubu dey expected to hold bilateral meetings on di sidelines of di Summit in advancement of Nigeria socio-economic reforms.

Di summit, wit di theme: “Building a Just World and a Sustainable Planet,” go focus on three dimensions of sustainable development – economic, social, and environmental – and di reform of global governance.

E go also highlight di rising of global temperatures and di principles of digital economy, among oda themes.

For di summit, leaders go tok about Israel–Hamas war and rising bloc confrontation between di United States and China.

In line wit di theme of di summit, Brazil President Luiz Inácio Lula da Silva declare a three-point agenda of combating hunger, poverty and inequality at di summit scheduled wey go hold from November 18 to November 19.

President Tinubu dey attend di summit sake of say President Da Silva invite representatives of di African Union and di European Union.

According to di Ministry of Foreign Affairs, Tinubu participation go strengthen Nigeria aspiration for permanent G20 membership and also provide a platform for diplomatic engagement and partnership wit G20 members.

For di G20 summit, Nigeria go actively contribute to discussions on fighting hunger and poverty and di reform of global governance institutions, according to di Ministry of Foreign Affairs.

Wetin be G20?

Di G20 - or Group of Twenty - na club of kontris wey dey meet, discuss plans for world economy.

Di members na Argentina, Australia, Brazil, Canada, China, France, Germany, India, Indonesia, Italy, Japan, Mexico, Russia, Saudi Arabia, South Africa, South Korea, Turkey, UK and US, di african Union and di European Union.

Dem dey always invite Spain as a guest.

Dis year, Nigeria President Bola Tinubu dey attend on di special invitation of Brazil President Luiz Inácio Lula da Silva.

One smaller group from di G20 kontris dey meet as G7.

Some of G20 member kontris - Brazil, Russia, India, China and South Africa - form anoda sperate group wey dem dey call Brics.

Wetin Nigeria go gain from di G20 summit?

"Any gathering wey include kontris wey dey control more dan 75 percent of global trade, and ova 60 percent of di world GDP, e no dey out of place if a kontri (like Nigeria) wey get arguably di biggest economy for Africa attend such a gathering," Tukur Abdulkadir, Professor of Political Science and International Relations for Kaduna State University, tell BBC Pidgin for phone interview.

"Nigeria as di largest market on di continent suppose even be a natural member of di G20. E dey quite surprising say South Africa na natural member, while Nigeria, wit di highest population, di biggest market, and now di largest economy on di continent no be member."

According to Prof Abdulkadir, e good as Nigeria dey get invitations to big global meetings like dis becos e go give dem di opportunity to build diplomacy, increase global partnership wit oda kontris and enhance dia international rating.

"I no believe say a kontri of ova 230 million pipo suppose to dey go to di international community cap-in-hand to dey beg for investors. Di main tin na for Nigeria to put dia house in order," e tok.

Professor Abdulkadir add: "We (Nigeria) dey lag behind in terms of technological breakthrough, we dey lag behind in terms of political and diplomatical acceptability.

"Diplomatically speaking today, in terms of clout and respectability within di international system, South Africa go trounce Nigeria anytime at any forum in terms of credibility, integrity and respect.

"And dis na di challenge to di leadership of Nigeria at all levels, you no need to have 230 million pipo to command di respect of oda nations."