Four key issues President Bola Tinubu and India Prime Minister Narendra Modi agree on during im visit

India prime minister shake President tinubu

Wia dis foto come from, X/Presidency

Read am in 4 mins

Nigeria and India don promise to work togeda for di areas of economic development, defence, healthcare and food security.

Dis na part of wetin dem tok for Abuja on Sunday during di visit of Indian Prime Minister Narendra Modi to Nigeria and President Bola Tinubu.

Dis go be di first visit of an Indian head of state to Nigeria in 17 years afta di visit of former Prime Minister Manmohan Singh for October 2007.

But Modi na di fourth Indian Prime Minister wey go visit Nigeria.

During di meeting, both India and Nigeria leaders also agree to collabo for area of maritime, intelligence and counter terrorism.

According to statement from di state house, President Tinubu recognise India for di various scholarship programs wey dem get to help students to learn.

Oda issues wey dem tok about include security for West Africa and opportunities to promote cultural interaction between Nigeria and India.

Key issues wey Nigeria and India agree on

Security

Di discussion between di Nigeria and India leaders bin focus on collabo wey go favour di two kontris.

Sake of of di threat for di Gulf of Guinea and the Indian Ocean, di two leaders agree say dem go get better actions wey go safeguard maritime trade routes and fight piracy.

Di two kontris bin promise to continue regular naval exercises and joint anti-piracy operations for di Gulf of Guinea to safeguard critical maritime routes.

''Di leaders bin condemn terrorism in all its forms and manifestations including di cross-border movement of terrorists and terror financing networks and safe havens.

''Dem call for zero tolerance to terrorism and adoption of di Comprehensive Convention on International terrorism for di UN Framework as well as implementation of di UNGA and di UNSC resolutions to counter terrorism and violent extremism," di statement tok.

Prime Minister Modi tok on how India ready to support Nigeria effort to modernize di defence system.

During di meeting, dem also tok about CNG conversion and LNG supply.

"Nigeria and India also agree on long-term contracts for crude oil and LNG supply and technical support for pipeline transmission security, CNG conversion and LPG bottling distribution," di statement tok.

India Prime Minister wit President Tinubu

Wia dis foto come from, X/Presidency

Economic and Trade relationship

Both President Tinubu and Prime minister Modi agree on how dem go collabo on economic and trade matter.

Dem highlight di economic relationship wey dey between Nigeria and India - wit India as one of di largest trading partner and contributor to di Nigeria economy.

"Nigeria bin commend di contributions of ova 200 Indian companies wey dey operate for di kontri and e dey generate substantial employment and investment opportunities," a joint statement of di countries tok.

Wen e reach di issue of bilateral trade expansion, both leaders bin direct dia officials to finalise pending agreements wey include di Economic Cooperation Agreement (ECA), Double Taxation Avoidance Agreement (DTAA), and di Bilateral Investment Treaty (BIT), to boost trade and investment.

Agriculture and Food Security

While di two leaders dey tok, dem agree say food security dey important to develop especially for di two kontris sake of dia population.

Nigeria also thank India sake of di necessary concessions wey help di supply of rice for di time wey dem need am.

''Dem agree to collabo for di area of agriculture wey include agricultural machinery, high yield seeds to sharing technical expertise, technologies and dem agree to identify ways wey dem go cooperate for dis areas."

''Di Indian side thank di Nigerian side for supporting di Indian Resolution for di UN to declare 2023 as di International Year of Millets and agree to increase collaboration between India and Nigeria for di area of millets, '' di joint statement tok.

Education and Healthcare

Oda areas wey President Tinubu and Prime minister Modi also touch on na di issue of health and education.

Di two kontris say dem go increase dia collabo to focus on how dem fit establish hospitals, diagnostic centers and di use of innovative health management systems.

According to di joint statement, "Both side acknowledge di ongoing efforts by Indian hospitals wey dey operate for Nigeria and touch on di potential to further collabo to help di healthcare delivery across di kontri"

Di Indian govment bin agree to help Nigeria wit one platform wey go help dem improve di health sector.

For di issue of education, di two kontri say dem go tie dia wrapper well-well to build relationship wey go last.

Both Modi and Tinubu tok on di various scholarship programmes wey India dey known for and how dem dey help to improve learning opportunities.

“Both sides agree to work togeda to encourage more Nigerian students to leverage dis scholarship programmes,” di statement tok.

During di meeting of dis leaders, President Tinubu honour di India Prime Minister Modi wit di award of di Grand Commander of the Order of Niger.

Meanwhile, from Nigeria, Modi go head to Brazil for di G20 Summit wey go happun for Rio De Janeiro from November 18-19.