Tributes pour in for Mbongeni Ngema, South African theatre legend wey die for car accident

Wia dis foto come from, GALLO IMAGES
- Author, By Nomsa Maseko
- Role, BBC News, Johannesburg
Tributes dey pour in for di South African playwright Mbongeni Ngema afta im die for car crash at age 68.
Im rise to international fame in di 1980s wit play wey dey depict di lives of black pipo under di racist system of apartheid.
Im work dey "reflect di spirit of resistance" during white minority rule, im family tok.
Ngema dey popular for im musical Sarafina, wey dem later adapt am into feem, featuring Whoopi Goldberg.
President Cyril Ramaphosa lead tributes to di playwright, composer and theatrical director.
Ngema "masterfully creative narration of our liberation struggle honour di humanity of oppress South Africans" and "expose di inhumanity" of di apartheid regime, di South African leader tok.
Im die for head-on collision on Wednesday evening wen e dey return from one funeral for di town of Lusikisiki in di Eastern Cape province.
More dan 700 pipo don die for car accidents in South Africa since di beginning of December.
End of Di one wey oda users dey read well well
Born in 1955, Ngema begin im career as backing guitarist before im begin enta stage for local theatre productions in di 1970s.
Im co-write di 1981 play Woza Albert! ( wey mean Rise Up Albert! for Zulu), wey imagine di second coming of Jesus Christ during di apartheid era.
Di satirical work become di benchmark of South African protest theatre at home and on di stage of London and New York.
Im follow up wit di musical Asinimali! (Zulu for We no get moni!), wey show off im exceptional technical abilities as a producer.
And den for 1987 im triumph Sarafina!, set during di Soweto Uprising and carrying to audiences worldwide di revolutionary ardour of South Africa youth. dem adapt am into one blockbuster movie for1992.
South African actress Sophie Ndaba tok say pipo go remember Ngema for generations to come.
"Thank you for inspiring us wit your creative work and music," she tok for di tribute wey she post for Instagram.
Some of Ngema play afta apartheid, wey end for 1994, cause controversy.
Im produce Sarafina 2 for 1995 to raise awareness about di plague of HIV/Aids, wey dem don ignore during apartheid.
Di new goment commission am at di cost of 14m rand ($750,000; £590,000) amount wey dem bin see as high and e trigger investigation by South Africa anti-corruption watchdog, di public protector.
Di probe find say di health department funding for di play na "unauthorised expenditure" and im message about HIV/Aids dey inadequate.
Ngema also find imself in di centre of di controversy for 2002 wit im song AmaNdiya (wey dey mean Indians for Zulu), wey dey accuse di South Africa Indian community of racism and exploitation.
Di Broadcasting Complaints Commission of South Africa ban am from airwaves, dem tok say e dey incite hatred.
Anti-apartheid icon Nelson Mandela, wey serve as South Africa first democratically elected president from 1994-1999, ask Ngema make im apologise.
"I tink say im no fit do nothing beta dan make im apologise if im don offend anyone wit racist lyrics," Oga Mandela tok at di time.
Ngema refuse and condemn di ban, im tell di BBC say no authority wey go direct wetin an artist fit write about.














