October 1st: Wetin be di relevance of Independence Day celebration without Parade

Wia dis foto come from, Presidency
Few hours from now Nigeria go celebrate dia 65th Independence.
Nigeria dey mark evri 1 October sake of say na di day wey di kontri get independence from dia colonial masters.
From 1960 wey di West African kontri get freedom from dia colonial masters, citizens and some foreign internationals dey always look forward to dis day.
One of di major highlights of Independence Day celebration na di parade wey security agencies dey do wey dey end wit di speech of di President.
But dis year, tins go change as Nigeria govment announce say dem no go do di usual parade.
For statement wey Nigeria govment release, wey Segun Imohiosen, Director, Information & Public Relations sign, dem announce say di cancellation no go still dey relevant without di regular parade.
"...di cancellation no go in any way reduce di significance of dis milestone anniversary, and di govment remain committed to celebrate Nigeria 65th year of Independence with dignity and enthusiasm"
According to dem all oda programmes go happun as planned as di statement no tok why dem cancel di parade.
Dis announcement no too sweet some Nigerians belle as many of dem dey always look forward to dis day sake of say e dey always dey colourful across di kontri.
For Abuja, di Nigeria capital, pipo dey always go gada for di popular Eagle Square.
Dem go wear different uniforms wey dey sometimes represent different cultural groups, traditions, civil society, and security agencies.
As e dey happun for di capital, e dey also happun for oda states across di kontri.
Na opportunity for pipo to wear di National colours of green and white wit different styles and designs.
But as gatherings fit no dey e no dey too sure how di celebration go be.
Di usual sale and display of green and white items for road and shops wey dey always welcome di celebration no dey like bifor.

Wia dis foto come from, Olukayode Jaiyeola/NurPhoto via Getty Images
Wetin be Independence celebration without parade?
Security Expert and Public Analyst, Austen Yong tok say weda parade dey or not, e no change anytin for di Independence Day celebration.
For interview wit BBC News Pidgin oga Austen tok say as individuals evribody dey celebrate birthdays in different way and if you no get money to celebrate am or you no wan do big party, e no mean say no be di day dem born you.
"No be di first time Nigeria govment dey cancel parade. Parade na just one component of di Independence Day celebration, dis days how many ordinary citizens dey go watch parade apart from maybe di military, some school children and some civil servants?"
Im add say notin spoil so far as di day reach and Nigeria celebrate freedom from dia British colonial masters.
"Di main essence of Independence na say we dey celebrate freedom, weda na total freedom, economic freedom or political freedom, di koko be say we no dey under anybodi rule again"
Im conclude say even though Nigeria govment no tok why dem cancel di parade, e fit be say dem don get report and no celebration wey worth any security risk.
Former President of Nigeria , late Muhammadu Buhari bin celebrate Nigeria Independence and di parade happun.
Some of di highlights from President Buhari last Independence Day speech bin focus on Nigeria economy and oda sectors.
For di event of Nigeria Independence Day celebration for 2024 wey be dia 64th anniversary, some human rights groups bin dey plan to hold protest across di kontri.
Di aim of di protest wey organisers bin say go dey peaceful na to end bad governance and di hardship wey Nigerians dey face.
For 2024, Nigeria experience dia worst economic crisis eva, wey bin show for di rise in food prices and petrol hike too.
For one survey wey di kontri Central Bank of Nigeria (CBN) bin conduct from 22 to 26 July 2024, e bin show say di rising inflation rate fit force Nigerian households to spend di largest amounts of dia earnings on food for six months.
Dis na as di most recent report by di National Bureau of Statistics (NBS) put di inflation rate at 33.40 per cent, and food inflation at over 40 per cent.
But for 2025, Nigeria govment bin tok say tins don beta pass bifor even though di kontri still dey face plenti challenges.









