Independence day 2022: Foto of Nigeria 62nd anniversary celebration

Nigeria president Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Nigeria mark dia 62nd anniversary wit national event for Abuja, di kontri capital.

Leaders of di west African kontri including president Muhammadu Buhari gada for Eagles square on Saturday wia dem watch parade and performances to mark di anniversary.

Di Military Parade na im be di high point of di activities of di celebration of Nigeria Independence.

Buhari last independence event as president

Di 2022 independence anniversary na di last on wey oga Buhari go head as Nigeria president.

For im independence day broadcast president Buhari say im believe say im don serve di kontri well.

E tok about di efforts of di ruling All Progressives Congress (APC) party, for re-setting di Nigeria economy as e survive two recessions.

Di president hail di very practical and realistic monetary and fiscal policy to make sure say public finance management dey work well.

E also hail di fact say im administration give priority to di agriculture sector through providing support for activities of micro, small and medium scale companies and dis don create millions of jobs.

E say im goment make appreciable progress to fulfil im promise of creating 100 million jobs.

Foto of independence day celebration for Abuja

Former president Goodluck Jonathan, Senate president Ahmed lawan, speaker of di House of representatives Femi Gbajabiamila, di armed forces and some members of di diplomatic corps attend di event.

Heads of Ministries and Parastatals, captains of industries, also dey di event.

Nigeria president Muhammadu Buhari for Eagle square Octover 1, 2022

Wia dis foto come from, Femi Gbaja/Facebook

Leaders of Nigeria National aseembly, Femi Gbajabiamila and Senator Ahmed Lawan

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Wetin we call dis foto, Leaders of Nigeria National aseembly, Femi Gbajabiamila and Senator Ahmed Lawan
Cultural performance for Nigeria independence day celebration

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Wetin we call dis foto, Cultural performance for Nigeria independence day celebration
Section of dignitaries for Eagles square, Abuja

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Wetin we call dis foto, Section of dignitaries for Eagles square, Abuja
More cultural performances for Nigeria independence day celebration

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Military parade for Nigeria independence day celebration 2022

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Wetin we call dis foto, Military parade for Nigeria independence day celebration 2022
Military parade for Nigeria independence day celebration 2022

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Military parade for Nigeria independence day celebration 2022

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

President Buhari and di armed forces

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Wetin we call dis foto, President Buhari, Nigeria leaders and di armed forces
President Buhari and di armed forces

Wia dis foto come from, Femi Gbaja

Nigeria vice president Yemi Osinbajo and im wife

Wia dis foto come from, Presidency

Nigeria president Buhari and Vice president Osinbajo

Wia dis foto come from, Presidency

Nigeria first and second families

Wia dis foto come from, Presidency