Five tins to look out for as Trump visit UK

Foto of President Trump and one flying flag for Windsor
    • Author, James Landale
    • Role, Diplomatic correspondent
  • Read am in 8 mins

US President Donald Trump state visit to di United Kingdom dis week, no be new tin, just as im first time six years ago.

Back den, for June 2019, e drink tea wit di late Queen, di US President call London Mayor Sadiq Khan "stone-cold loser", e back Boris Johnson for di Tory leadership race and suggest say NHS suppose be part of US-UK trade toks.

All dis na afta one petition, tok say make e no receive state visit in di UK, more dan one million pipo sign am, as well as noisy protests involving thousands and huge inflatable effigy wey pipo sabi as di Trump Baby.

Dis week second state visit – na unprecedented for non-royal.

US President Donald Trump (R) and di US First Lady Melania Trump (L) as dem dey waka on di tarmac

Wia dis foto come from, Mandel Ngan/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Uk invite Trump for second state visit (pictured above during im last visit, wit First Lady Melania, in 2019)

Anoda protest fit dey again and Lord Mandelson wey dey serve as UK ambassador to di US don already cause concerns ova proceedings.

Planning for di visit - ova Wednesday and Thursday - don dey go on for months, but for all di careful preparation, di possibility say tins fit go wrong still dey very real.

And for many of pipo wey dey organise am, di Mandelson affair na only one of dia worries.

How Windsor become 'Trumpton'

For dos wey dey di royal end of di show, di focus dey on logistics and security - and turning Windsor Castle into ring of steel hard enough to satisfy even di most hard to please secret service agents.

One Stars and Stripes flag wey dem display outside Windsor Castle in advance of di second state visit to di UK of US President Donald Trump and First Lady Melania Trump on 11th September 2025 in Windsor, United Kingdom

Wia dis foto come from, Mark Kerrison/In Pictures via Getty Images

Wetin we call dis foto, Detail planning for di visit don go on for months, down to banquet menus, seating plans and wording of di King seven-minute speech

For Palace officials, attention to detail dey important.

One of di biggest problems na to find place to muster di Household Cavalry.

E need to dey far enough from di helicopter landing zones to ensure di horses no dey fear di noise, close enough to form di escort quickly wey go accompany di Trumps carriage procession through di grounds of Windsor Castle.

Discussion dey between di Palace and Foreign Office ova who dey sit wia for di State Banquet for St George Hall.

"Di value of dis tins no be just di photo opportunities but also all di off-grid conversations," one royal insider tok.

"Big attention dey go into di seating plan for di banquet. So pipo wit certain policy areas go sit next to one anoda."

Members of di Mounted Household Cavalry gada on The Mall ahead of di Ceremonial Welcome for President of South Korea, 2023 in London

Wia dis foto come from, Jonathan Brady - WPA Pool/Getty Images

Wetin we call dis foto, One challenge na to make sure say di helicopter landing zones dey positioned to ensure di horses of di Mounted Household Cavalry (pictured) no dey fear di noise

'Pressure to make dis big'

So far, so good logistical – but di key challenge for royal organisers na to find way of ensuring say Trump feel dem don give am full state visit. No be easy task.

Di president dey on di ground for less dan 48 hours and e no go visit Downing Street, address Parliament or even find time to play golf.

"Large amount of govment pressure don dey make am dis big and dat na di challenge," one courtier tell me.

President Donald Trump (far left), Queen Elizabeth II, First Lady Melania Trump, Prince Charles Prince of Wales and Camilla Duchess of Cornwall attend one State Banquet for Buckingham Palace on June 3, 2019 for London

Wia dis foto come from, Jeff Gilbert - WPA Pool/Getty Images

Wetin we call dis foto, President Trump (pictured on im first state visit to UK) go return for a second state visit dis Wednesday and Thursday

Di scale of di ceremonial for Windsor don step up, wit 1,300 troops and 120 horses wey dey involve - far more than di one wey dem use wen President Macron of France visit earlier dis year.

One Whitehall source say: "Di focus dey very much on di optics, di historic moment, di pomp. For Trump na all about TV and dis na great TV."

Anoda tok say: "Na theatre. Na all show. E no be like say dem go do deep substance. We dey wit di most powerful guy in di world for good reason."

Members of di Guard of Honour

Wia dis foto come from, Peter Nicholls/Getty Images

Wetin we call dis foto, Members of di Guard of Honour rehearse di ceremonial welcome

Di Trumps: Warm and solicitous guests

Lord McDonald, former top civil servant in di Foreign Office, tok say di UK strategic choice to afford di most powerful man in di world " na di fullest honour British protocol go allow" and di rest of di world dey watch closely.

"Dis state visit no be just UK-US event," e tok. "E don become one of di biggest stories around di world.

"Di rest of di world go dey look at London and Windsor, di UK wider international standing."

Many officials dey confident say di visit go, go smoothly, simply becos all di sides want am to succeed.

Dem emphasise say Palace staff tink say di Trumps na warm and solicitous guests in 2019.

US President Donald Trump and di den Prince Charles during one welcome ceremony for Buckingham Palace for central London on June 3, 2019

Wia dis foto come from, Mandel Ngan/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, President Trump and King Charles go make speeches for one banquet during di state visit

"Trump dey quite funny in private," one diplomat tok. "E get quite a neat turn of phrase wey di King go appreciate."

For di UK govment, di overwhelming aim na for Air Force One to take off on Thursday evening wit Trump warmly dispose to Britain.

Serious business behind di pageantry

Beyond providing di one day of royal pageantry, di govment get business to conduct on Thursday wen proceedings go be to move to di prime minister residence for Chequers.

Ministers hope to complete one deal to exclude UK steel and aluminium from US tariffs. Dem go get some new civil nuclear cooperation.

Di centrepiece na to set di signing of one technology partnership, involving new investment in Britain and greater cooperation with Silicon Valley on artificial intelligence and quantum computing.

Dis na Lord Mandelson priority, something e describe for im outgoing letter to embassy staff last week as "my personal pride and joy", e claim say e go "help write di next chapter of di special relationship".

All dis issues go dey like big domestic "wins" to help promote di govment growth agenda.

UK Prime Minister Keir Starmer and US President Donald Trump shake hands for one joint press conference for di East Room for di White House on February 27, 2025 for Washington, DC

Wia dis foto come from, Carl Court - Pool/Getty Images

Wetin we call dis foto, Ministers dey hope to complete one deal to exclude UK steel and aluminium from US tariffs

Di visit go also provide Prime Minister Sir Keir Starmer wit significant opportunity to bend di ear of di president just one week bifor di United Nations general assembly for New York, especially on Ukraine.

Jeremy Hunt, Foreign Secretary wey dey heavily involved in di last Trump state visit, tok say dis na key chance to shape di president thinking.

"Trump appear to dey on a journey away from Putin, towards recognising e need di standing of im European allies beta," Hunt tok.

"Wetin di govment go really want do na to continue dat journey, looking for deal to impose more sanctions on kontris buying Russian oil."

One large "ring of steel" security fence surround some section of di Long Walk for Windsor

Wia dis foto come from, Leon Neal/Getty Images

Wetin we call dis foto, Planning heavily focus on security - and turning Windsor Castle into ring of steel

Planning dey heavily focused on security - and turning Windsor Castle into di ring of steel

Sophia Gaston, senior research fellow for King College London, tok say di state visit na important chance for di UK to influence US policy at dis crucial stage of di Trump administration, na opportunity for di first six months and next year wen di focus fit shift to domestic elections and strategic competition wit China.

"We dey move into new phase," she tok. "Dis state visit go really mata. Na about us securing one foothold as di primary symbolic and strategic ally of di United States."

Di diplomatic game of cards

Di diplomatic game of cards, wey di govment dey play on di King na for political purposes?

"Di govment get di convening power of di King and dem fit use am in transactional way, for example di brandishing of di King letter for di Oval Office," one royal source tok.

"Dem realise say di Palace fit draw pipo in ways dem no fit for Whitehall.

US President Donald Trump plus di den Prince Charles, Prince of Wales pose ahead of one dinner for Winfield House on June 04, 2019 for London, England

Wia dis foto come from, Peter Summers/Getty Images

Wetin we call dis foto, Na only three state times US presidents don visit UK: President Bush in 2003; President Obama in 2011 and President Trump in 2019

"Di problem be say dem dey use di personality of di monarch and di institution of di monarchy, e dey risky to cross di line and you ask someone wey be non-political actor to transact political act on behalf of di govment."

Official state visit by US presidents dey rare. Na only ever three times e don hapun: President Bush in 2003; President Obama in 2011 and Trump in 2019. All oda visits na official or informal.

But even if e go smoothly pipo go still ask questions weda e dey effective . "E dey very key for Trump presidency," one diplomat tok.

"We don play dis card too soon? Wetin we go do now na to play again?"

Top picture credits: Win McNamee/Getty Images, Neil Hall /EPA/Shutterstock and Hollie Adams, WPA Pool/Getty Images, Yuri Gripas/Abaca/Bloomberg via Getty Images

Get in touch

InDepth is the home for the best analysis from across BBC News. Tell us what you think.