Tinubu remove Uni Abuja VC, make major changes for federal universities

Wia dis foto come from, University of Abuja/Facebook
President Bola Tinubu don approve major changes for some federal universities.
Di changes na re-energise di higher education system for Nigeria through dynamic leadership and accountability, according to presidential tok-tok person, Bayo Onanuga.
Di changes affect di University of Abuja, University of Agriculture, Makurdi, Alvan Ikoku University of Education, Owerri Imo State, University of Nigeria, Nsukka, Enugu State, among odas.
For UniAbuja wey goment bin rename afta former Head of State Yakubu Gowon, Tinubu comot Aisha Sani Maikudi as Vice Chancelor and also dissolve di entire governing council.
Di President appoint Professor Lar Patricia Manko as di acting VC for just six months and she no go dey eligible to apply for di post of substantive VC.
Also Lanre Tejuoso, a former Senator, go now be di Pro Chancellor of di University of UniAbuja.
Other Pro Chancellor appointments na:
- Senator Joy Emordi - University of Agriculture Makurdi, Benue State;
- Gen Ike Nwachukwu - University of Uyo, Akwa Ibom State;
- Olubunmi Kayode Ojo - University of Nigeria Nsukka (UNN), Enugu State;
- Zubairu Tajo Abdullahi - Federal University Lokoja, Kogi State;
- Senator Sani Stores - Alvan Ikoku University of Education Owerri, Imo State;
- Olugbenga Kukoyi - Nnamdi Azikiwe University Awka, Anambra State.
For di Vice Chancellor positions, di new appointments na:
- Prof Lar Patricia Manko - Yakubu Gowon University, Abuja (Acting for six months)
- Prof Oguejiofo T. Ujam - University of Nigeria, Nsukka (acting for six months)
End of Di one wey oda users dey read well well
"Dis restructuring na to strengthen governance and academic excellence within Nigeria's tertiary education sector," oga Onanuga add for di statement wey e issue on Tozde.
E also add say all di appointments na wit immediate effect.
Uniabuja VC appointment crisis
Di University of Abuja, wey goment now rename to Yakubu Gowon University bin don dey in crisis since late 2024 sake of di appointment of Aisha Maikudi as di substantive Vice Chancellor.
Born in January 1983, Maikudi - a professor of International Law - bicom di acting VC of Uni Abuja on 28 June, 2024 at di age of 41, afta di tenure of di former VC, Abdul-Rasheed Na'Allah, bin expire.
Tori be say she be di youngest professor so far for di University, and she bin don serve as Deputy VC Academics.
However, in January dis year, about 43 professors for di University bin write protest letter to President Tinubu wia dem allege say di appointment of Maikudi as substantive VC on December 30, 2024, no follow due process sake of say she no dey qualified for di post.
According to di tori, di professors tok say Maikudi just dey two years as a professor bifor her appointment as VC and dem also say dem no longer get any confidence for di governing council of di university.
"We dey urge you to take immediate corrective action to restore di integrity of di process by dissolving di Governing Council dissolved and reconstitute a new one so dat a fresh and free process of Vice Chancellorship appointment go dey conducted," dem write for dia letter, according to tori pipo Vanguard.
Days afta dem write di letter, di professors also do peaceful protest for di headquarters of di Ministry of Education on 7 January to still press dia demands.
E appear say na all di protests na dem lead to di action wey President don take now to remove Maikudi as VC and also dissolve di university governing council.














