Veteran Nollywood actor Columbus Irosanga don die

Wia dis foto come from, Columbus Irisoanga /Instagram
Veteran Nollywood actor, Columbus Irosanga don die, anoda veteran star Hilda Dokubo announce.
Dokubo wey share di same state wit Irosanga make di announcement via post on her official Instagram handle.
"Shortage of angels for heaven no fit dey wey dem call di few hia home like dis na! Dis one heavy on Uniport Rivers State Nollywood," she tok.
She also post for her X handle and pipo don begin react to dis tori of Columbus death as dem mourn di veteran actor.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
While some dey write condolence messages to im family and loved ones odas still dey joke ontop im death.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
Profile of Columbus Irisoanga
According to local media and different social media posts, Dr Columbus Irosanga until im death na veteran Nigerian actor, academic, and television personality.
Im focus wen im bin dey go school na mainly on theatre as im read reach PhD.
Na senior lecturer for di Department of Theatre Arts for di University of Port Harcourt wia im bin dey teach and train upcoming actors.
Im dey popular well-well for im roles as 'Eyes of di gods' as im act for plenti feems.
Some of im popular feems na 'Isakaba' (2003) and '7 Kilometre' (2015).
Di late Dr Irosanga also chook hand for projects wey dey showcase di culture of Nigeria and her rich history.
For one feem 'Amanyanabo The Eagle King', wey dem record for im village for Okrika, im show im determination to promoting local heritage.