Taoreed Lagbaja, Herbert Wigwe, Junior Pope and odas wey dia death shake Nigeria for 2024

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X/Instagram
Death na one inevitable tin wey evri human go experience.
Evriday, living tins (human being, animals, plant and more) dey experience death. Some deaths dey happun witout much notice and some dey happun wey dey shake evriwia.
Like many past years, 2024 record im own share of deaths wit some wey loud reach evriwia.
Inside dis listicle, BBC Pidgin take dis moment to remind us about deaths wey shake Nigeria for di year 2024.
Senator Ifeanyi Ubah

Wia dis foto come from, Ifeanyi Ubah/X
Di tori of di death of di senator bin reach di public on Saturday 27 July 2024.
According to tori, di Anambra South Senator bin die for age 52 for one London hospital afta e battle wit illness wey dem no tok.
Senator Ifeanyi Ubah na popular politician wey dey represent Anambra South Senatorial Zone for di National Assembly.
President Bola Tinubu and some oda ogbonge Nigerians bin send condolences to di family of di late senator.
Herbert Wigwe

Wia dis foto come from, X/ Herbertwigwe
On Friday 9 February 2024, Nigerians bin wake up to hear say Chief Executive Officer (CEO) of Access Holdings, Herbert Wigwe die for one helicopter crash for America.
Di ogbonge banker bin die along wit im wife Doreen Wigwe and first son Chizi Wigwe.
Di crash bin happun around Nevada border for California, United States dat Friday evening.
Access Holdings bin tok for statement dat time say, "Dr Wigwe na key driving force wey bring remarkable passion, energy and experience to come transform di Access franchise since im join di bank for 2002."
Wigwe bin get big vision to make Access Holdings Africa biggest, wit all di unquenchable thirst for acquisitions. E also make mark for im community, by building a university, wey e bin say go make one big difference.
Im school, Wigwe University for Isiokpo, Rivers State, Nigeria, bin officially open on Thursday, 17 October, 2024.
John Okafor aka Mr Ibu

Wia dis foto come from, @realmribu/Instagram
Ogbonge Nollywood actor, John Okafor aka Mr Ibu bin die on Saturday 2 March for one Lagos hospital wia im bin dey receive treatment for illness wey give am long-time problem.
Mr Ibu na actor, stand-up comedian and MC from Enugu State, Southeast Nigeria.
E bin don battle di serious health challenges for 2023 and im bin dey hopeful say im go fit survive am but e later die.
Plenti ogbonge pipo for Nigeria and within di entertainment industry bin pay condolences to di popular Nollywood actor.
Nigerians no go quick forget di late actor sake of di hilarious role wey im bin dey play for movies.
Junior Pope

Wia dis foto come from, JUNIOR POPE/INSTAGRAM
Dis na one death wey be like many. Just as Nigerians dey try forget about di death of Mr Ibu, anoda tragedy bin hit Nollywood industry.
John Paul Odonwodo wey dey popular as Junior Pope bin die afta e involve for one boat accident wen e bin dey shoot movie
Report first begin spread for 10 April say Junior Pope drown afta boat wey im and some movie crew members dey inside bin capsize for River Niger on 10 April 2024.
President of di Actors Guild of Nigeria (AGN) Emeka Rollas Ejezie bin later confam di death of Junior Pope for im Facebook account on Wednesday 11 April afta many pipo don confuse weda di actor truly die or not.
Junior Pope death bin make di Nollywood industry to consider safety, especially on waterways.
Onyeka Onwenu

Wia dis foto come from, Getty Images
On 30 July 2024, legendary musician Onyeka Onwenu bin die at age of 72.
Di announcement of her death bin shock many pipo sake of say she bin perform for event dat evening.
According to tori, di ogbonge singer bin slump while she dey perform for di event wey hold for Lagos and no make am back to life despite quick medical intervention.
"Di Elegant Stallion", as dem dey call Onyeka Onwenu, go remain evergreen for di minds of many Nigerians sake of di kain music wey she don sing.
President Tinubu for im condolence message to her family bin describe Onyeka Onwenu as one versatile and extremely gifted artiste wey apply hersef to di whole gamut of artistic enterprise and expression, wey bring joy and laughter to many.
Rukayat Gawat

Wia dis foto come from, RUKAYAT GAWAT/FACEBOOK
Early Tuesday morning of 24 September, Nigerians bin wake up to hear about di death of popular Islamic singer Rukayat Gawat-Oyefeso.
Late Rukayat Gawat dey popular for her style of Islamic music and captivating voice wey many Muslim pipo dey like to listen to.
Na one popular cleric Alfa Aribidesi At-Tawdeeh Islamic Da'awah wey base for Ilorin, Kwara State, North-Central Nigeria, bin break di tori for im social media page.
Broda to Late Ms Rukayat, Jubril Gawat, bin also confam di death for social media X wia e bin post one Quranic verse wey tok about death.
Late Rukyat Gawat-Oyefeso na pikin of one popular broadcaster Alhaji Rasaq Aremu Gawat wey go missing years ago. Di whereabout of Aremu Gawat never dey known till date.
Chief of Army Staff (COAS), Taoreed Lagbaja

Wia dis foto come from, Nigerian Army
President Bola Tinubu bin announce di death of Chief of Army Staff, Lt Gen Taoreed Abiodun Lagbaja on 6 November 2024.
Chief of Army Staff bin die for Lagos on Tuesday night of 5 November afta e battle illness wey dem no disclose.
Bifor im death, Nigerians bin already dey ask questions about di whereabouts of di army chief afta im absence dey noticed.
Di pressure about wia im dey bin mount afta president Bola Ahmed Tinubu announce di appointment of a new acting Chief of Army Staff (COAS).
Dem born late Lt General Lagbaja for February 28, 1968, bifor Tinubu come appoint am as Chief of Army Staff for June 19, 2023.
Late Lt General Lagbaja bin start im military career wen e enta di Nigerian Defence Academy for 1987.










