Jimmy Carter die at 100: Di peanut farmer wey become US president

Jimmy Carter at an older age

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 9 mins

Former US President Jimmy Carter don die at di age of 100, di centre e found don confam.

Di former peanut farmer bin live longer dan any president in US history and celebrate im 100th birthday for October.

Di Carter Center, wey dey advocate for democracy and human rights around di world, say e die on Sunday afternoon for im house for Plains, Georgia.

Afta di Watergate, Jimmy Carter sweep to power and promise say im no go lie to di American pipo.

Di peanut farmer from Georgia bin pardon Vietnam draft evaders and become di first US leader to take climate change seriously.

On di international stage, im bin help to broker a historic peace agreement between Egypt and Israel, but e struggle to deal wit di Iran hostage crisis and di Soviet invasion of Afghanistan.

And as a result of warming relations during di 1970s, Carter bin announce for 1979 say Washington go establish formal diplomatic relations wit Beijing.

Dis mean say di US gatz break ties wit Taiwan and close dia Taipei embassy.

After a single term for office, Ronald Reagan sweep am aside, as Carter win just six states for 1980.

White House, Carter become tireless worker for peace, di environment and human rights, and dis na why dem recognise am wit a Nobel Peace prize.

For 77 years, im wife Rosalynn support am, until she die for November 2023. In tribute, e say she be "my equal partner in evritin I ever accomplish".

Di longest-lived president for US history, e don dey treated for cancer and don enta hospice care for im modest home for Georgia.

Basketball and Baptist faith

Dem born James Earl Carter Jr was on 1 October 1924 for di small town of Plains, Georgia, and na di eldest of four children.

Im segregationist papa bin start di family peanut business, and im mama, Lillian, na registered nurse.

A younger Jimmy Carter shovelling peanuts

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jimmy Carter dey shovel peanuts for 1971

Carter na star basketball player for high school. Im experience of di Great Depression and staunch Baptist faith support political philosophy.

Im bin spend seven years for di US Navy - and na dis time e marry Rosalynn, a friend of im sister - and become a submarine officer. But on di death of im papa for 1953, e return to run di ailing family farm.

Di first year crop fail through drought, but Carter bin turn di business round and make imsef wealthy in di process.

E bin enta politics on di ground floor, dem elect am to a series of local school and library boards, bifor im run for di Georgia Senate.

Civil rights campaigner

American politics bin dey ginger afta di Supreme Court decision to desegregate schools.

Bicos say im be famer from southern state, pipo bin expect Carter say e go oppose reform but im no follow im papa footsteps for dis mata.

For di two terms wey im hold for di state senate, e dodge kasala wit segregationists including di one wey come from di Democratic party.

But wen e bicom govnor of Gerogia for 1970, na im e bicom more public about im support of civil rights.

Jimmy Carter and Martin Luther King senior.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jimmy Carter for Georgia wit Martin Luther King papa. Carter bin campaign for civil rights for di 1960s

For im inaugural speech, im tok say, "I tell you ture-true, say di time for racial discrimination don finish."

E put pictures of Martin Luther King for di walls of di capitol building as di Ku Klux Klan bin dey protest outside. E bin make sure say im put African Americans bin dey appointed to public offices.

Carter bin dey hold groundnut for im presidential campaign

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Carter bin dey hold groundnut for im presidential campaign to show say im get simple roots

But e bin hard for am hard for am to match im strong Christian faith wit im liberal instincts on top di mata of abortion law. So even though e support di rights of women to abort, e no gree increase di funding so dat go fit happun.

As Carter start im campaign to bicom president for 1974, di kontri still dey deal wit di Watergate scandal. So e bring imself as simple peanut farmer wey di bad behaviour of professional politicians for Capitol Hill neva stain.

Jeans for di White House

E comot for di best time. Americans bin dey find outsidr and Carter fall as am.

Surprise bin dey wen e confess (for interview wit Playboy magazine) say e bin don "commit adultery for im mind plenti". But dem no see any kurukere waka for im life.

For di beginning, polls bin show say only 4% of Democrats bin dey support am. But just nine months later, im beat di incumbent Gerald Ford.

Jimmy Carter bin dey hold up di peace sign and smile wit im family

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jimmy Carter wit im family dey celebrate dia winn of di 1976 election

For im first full day for office, e pardon hundreds of thousands of men wey escape service for Vietnam by either going abroad or say dem no gree register.

One Republican critic, Senator Barry Goldwater, call di decision "di most disgraceful tin wey a president don ever do". Carter confess say e be di hardest choice wey im make for office.

E appoint women put for key positions for im administration, bin encourage Rosalynn to maintain national profile as First Lady and ginger Equals Rights Amendment to enta di US Constitution wey promise to legal protection against discrimination on di grounds of sex but e no work.

As one of di first international leaders wey take climate change seriously, Carter wear jeans and sweaters for di White House and dem come reduce heating to conserve energy.

Im install solar panels for di roof wey President Ronald Reagan go later comot, and pass laws wey protect millions of acres of unspoiled land for Alaska from development.

Disastrous rescue mission

Im "fireside chats" for television bin dey relaxed on purpose but as kasala start to increase, na im dis approach start to look to informal.

As di American economy continue to enta recession na so Carter popularity start to dey fall.

E bin try to ginger di kontri to accept di strict measures to take handle di energy crisis wey include fuel rationing but di Congress bin no gree for am at all.

Pans to introduce universal healthcare system bin also fall for legislature as unemployment and interest rates bin dey rise.

Im Middle East policy bin make sense for di beginning, as President Sadat of Egypt and Prime Minister Begin of Israel sign di Camp David accords for 1978.

President Sadat, President Carter and Prime Minister Begin

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Sadat of Egypt and Prime Minister Begin of Israel sign di Camp David accords for 1978

But success abroad no last. Di revolution for Iran wey cause di seizing of di American hostage and di Soviet invasion of Afghanistan bin dey as ogbonge tests.

Carter break diplomatic relationship wit Tehran and arrange trade sanctions to ginger di release of di Americans.

Blindfolded hostage among group of men

Wia dis foto come from, Getty Images

Di plan to rescue dem by force also fail yakata, and cause di death of eight American servicemen die. Di mata almost certainly end di hope of re-election.

Defeat by Reagan

Carter bin manage beat serious challenge from Senator Edward Kennedy for di 1980 Democratic presidential nomination and e achieve 41% of di popular vote for di next election.

But e no reach to pursue im Republican opponent, Ronald Reagan. Di former actor enta di White House wit electoral college win.

On im last day as president, Carter announce say di successful completion of di negotiations for di release of di hostages. Iran bin dey delay di time of dia release until afta President Reagan bin dey swore in.

Jimmy and Rosalynn Carter, Nancy and Ronald Reagan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jimmy and Rosalynn Carter, bin dey welcome Nancy and Ronald Reagan enta di White House for 1980

Carter bin get one of di lowest approval ratings of any US president wen e dey comot office. But in di next years, im do plenti tins to take restore im reputation.

E go peace mission for North Korea on behalf of di US goment wey turn to di Agreed Framework, wey be early effort to reach accord so dem go fit scata dia nuclear arsenal.

For 2002, Carter bicom di third US President afta Theodore Roosevelt and Woodrow Wilson wey go win di Nobel Peace Orize. And im go be di only one wey go win am for wetin im do afta im presidency work.

Nelson Mandela and Jimmy Carter about to shake hands.

Wia dis foto come from, Getty Images

E tok for im Nobel lecture say, "di most serious and universal problem na di growing gap between di richest and di poorest pipo for di world."

E collabo wit Nelson Mandela to found The Elders, wey be group of global leaders wey commit demselves to work on peace and human rights.

No ambition to bicom rich

For retirement, Carter go for modest life.

Im bin avoid ogbonge speaking appearances and seats for corporate boards and instead bin live simple life wit Rosalynn for Plains, Georgia wia dem born di two of dem,

Carter bin no wan make money from im time for di Oval Office.

E tell Washington Post say, "I no see anytin wrong wit am, I no blame oda pipo wey do am. E no just be my ambition to dey rich."

E be di only modern president wey go return full-time to di house wey im bin dey stay bifor im join politics. Di house na single floor, two bedroom house.

According ot di Post, di Carters' home bin dey valued at $167,000 wey be less money dan di Secret Service motor wey bin dey outside to protect dem.

For 2015, e announce sat e bin dey get treatment for cancer, di same disease wey kill im parents and three sisters.

Just some months afta e do surgery for broken hip, e go back to work as volunteer buiders of Habitat for Humanity. Di former president and im wife bin don dey work wit di charity since 1984 and e don help to fix ova 4,000 houses.

E continue to dey teach Sunday School for Maranatha Baptist Church for Plains wia e dey sometime welcome Democratic presidential hopefuls come im class. Im political philosophy na collabo of im conservative small-town home training, and im natural liberal instincts.

But wetin really ginger im life of public service na im deep religious beliefs.

E tok say, "you no fit to comot religious beliefs and public service. I no eva see kasala between God will and my political duty. If you violate one, you violate di oda."